Jump to content

Charmaine Pereira

From Wikipedia

Charmaine Pereira na raita an feminist skola wey dey Abuja, for Naija. Shi dey rait abaut hau wuman tek dey tink tins, mata wey konsain wuman an man, hau pipul tek len abaut man an wuman, an hau govment an sosaiti dey afet wumen. Shi stil bi kodinato for Initiative for Women’s Studies in Nigeria, wey dey hep stodi wumen mata for Naija. Shi folo join Tapestry Consulting, one oganaizeshon wey dey trai balans tins for wokplez mek men an women get ikwol chanz for Africa.

Abaut ha life

[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 1991, Pereira get PhD for Psychology of Edukeshon fom The Open University—wey mean sey shi stody how pipu tek len an how edukeshon dey afet mind.

For 2004, shi an one wuman wey dem kol Jane Bennett join hand rait one buk wey dem kol Jacketed Wumen: Qualitative Research Methodologies on Sexualities and Gender in Africa. Dis buk tok abaut how pipu fit stodi gender an sexual life for Africa.

Right now, Pereira dey tich for Sociology Department for Ahmadu Bello University (ABU). Ha wok dey luk into how kolsho, gender, how pesin lik do, lor, an religion dey mix togeda an how e dey afet pipu wey dey research hol dis tins.

Som buks an artiku wey shi don rait

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  • Pereira, Charmaine. Gender in the Making of the Nigerian University System. James Currey, 2007. (Buk wey tok abaut how gender tek shape university edukeshon for Nigeria.)
  • Pereira, Charmaine (Editor). Changing Narratives of Sexuality: Contestations, Compliance and Women’s Empowerment. Zed Books, 2014. (E tok abaut how pipu dey chenj di way dem ci sexuality an wumen pawa.)
  • Bennett, Jane & Charmaine Pereira (Editors). Jacketed Women: Qualitative Research Methodologies on Sexualities an Gender in Africa. United Nations University Press, 2013. (Buk wey tok abaut difren ways pipu fit stodi gender an sexual life for Africa.)
  • Pereira, Charmaine. “Domesticating Women? Gender, Religion and the State in Nigeria Under Colonial and Military Rule.” African Identities 3.1 (2005): 69-94. (Dis one chek how govment an religion don uze pawa tek kontrol wumen for Nigeria during colonial taim an military rule.)

Wia dem gada di tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]