Carrie B. Grover

From Wikipedia
Carrie B. Grover
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromCanada, Amerika Chenj-am
Orijina nemCarrie B. Spinney Chenj-am
Fest nemCarrie, Blanche Chenj-am
Famili nemGrover Chenj-am
Wen dem bon am13 July 1879 Chenj-am
Ples wey dem bon amBlack River Chenj-am
Wen e kpai1959 Chenj-am
Place of deathNew Jersey Chenj-am
Place of burialGorham Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey dutraditional folk singer, fiddler, folk song collector Chenj-am
Pat of wok wey e put mindtraditional folk music, folk music collection Chenj-am
Wie e go skulGould Academy Chenj-am
Wie e dey livSunken Lake, Newry, West Gorham Chenj-am
Instrumentfiddle, voice Chenj-am
Stai of song abi fimtraditional folk music Chenj-am
Described at URLhttps://carriegroverproject.com/about-carrie-grover/ Chenj-am

Carrie Blanche Grover (dem bon am for 1879 an e kpai for 1959) na Kanada tradishonal singa, an pesin wey dey kip tradishonal song an e sabi play Violin. Pipul respet am on tradishonal song an som of e song dey rekod of di Librari of Kongress wey Alan Loma an Sidney Robertson Cowell put dia.

How e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Nova Scotia dey bon Carrie Spinney in 1879. Grover stey for Nova Scotia onti e rish 12 year old. Grover papa nem na George Craft an e mama nem na Eliza Long. Di famili kom pak go Maine an e kom go Gould Akademi Wen one raita wey e nem na Fred Lincoln Hill wan tok abaut Grover e tok sey: " Na from famili wey dey du farma, dey grind korn an dey kut faya wood e tek kom from. E don tey wey e gra gra papa dem kom Amerika.In fact, e famili don kom Amerika bifor di time wey Amerika stat to fight for Indipedet wit Inglish, Scotch, Welsh an Irish pipul. Grover mama famili-dem an papa famili-dem sabi sing wel wel. In 1896, Carrie mari Almon Roy Grover in 1896 an na Gorham town dey both live. Di marej produs three pikin: Gertrude, Ethel an Roy.

E tradishonal muzik[chenj-am | chenj-am for orijin]

Afta wey pipul don no am wel wel as tradishonal muzik singa, Grover in 1941 rekod 87 songs an Violin sound for di Librari of Congress. Di Librari of Congress tok sey: "Mrs. Grover sit-down in front of mikrofone an rekod twenty-skx disc. Di song wey e rekod som of dem don pass ova 100 years" Rekod wey Grover du also dey pat of Eloise Hubbard Linscott koleshon. Na Grover bi di onli Niu England Wuman wey dey play Violin wey de inside di koleshon. Linscott tok sey e rili hapi sey Grover rekod de e koleshon. Linscott tok sey wetin Grover no sing e yuz violin tok am from e ova 400 song wey Grover get.