Branwen Okpako
Prof. Branwen Kiemute Okpako (bon 25 February 1969), na Nigerian pesin, wey leta bi Welsh-German fimmeka. Dem sabi am wel wel as di pesin wey dey dairet beta films lik: The Education of Auma Obama, Dirt for Dinner, and Landing. No bi onli fim directing shi sabi do, shi stil bi raita, produsa, pesin wey dey kontrol camera (cinematographer), fim editor, plus lecturer
Pasonal life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Dem bon am for Lagos, Nigeria on 25 February Wen shi rish 16 years, shi komot go Wales. By 1991, shi don get B.Sc. for Political Science fom Bristol University, England. Leta, shi go German Film and Television Academy Berlin (DFFB) wia shi len how to direct fim an finish for 1999.
Shi mari Johannes Brandrup, but dem leta divorce.
Wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]As shi dey do her final year for DFFB, shi produs ha fest short fim wey dem kol Dreckfresser for 2000. Di fim na abaut di fest Black policeman for East Germany. Di film win plenti international awords lik:
.IG Media Award for Dok Leipzig (2000)
.Distributions Prize fom Sales (2000)
.Bavarian State Government Documentary Award “The Young Lion” (2001)
.Best Graduation Film for See Docs Dubrovnik Festival
.For 2003, sh direct one fiction film wey dem call Tal der Ahnungslosen. Di film first show for Toronto International Film Festival dat year and later enter Panafrican Film and Television Festival of Ouagadougou (FESPACO) for 2005.
Afta di success of ha first two fims, shi dairet dokumetri fim Die Geschichte der Auma Obama for 2011. Dis fim win Viewers Choice Award for Africa International Film Festival. Di fim tok abaut di earli life of Auma Obama, wey bi di sista of former US President Barack Obama. Bikos shi an Auma Obama bi klose padi, shi tel am di stori well. For 2012, di film win:
.Africa Movie Academy Award for Best Diaspora Documentary
.Festival Founders Award for Best Documentary (Pan African Film Festival, Los Angeles).
For 2014, shi do one documentary-drama fim Fluch der Medea, wey tok abaut di life of German raita Christa Wolf. Di fim first sho for Berlin International Film Festival dat sem year.
Apart fom fim, shi don do plenti theater plays lik:
.Schwarz Tragen (2013)
.Maggie Burns (2009)
.Scramble Quiz Video (2008)
.Das Singende Kamel (2007)
.Bloodknot (2007)
.Seh ich was, was Du nicht siehst (2002).
Apat fom hol dis wok, sh stil bi Associate Professor for University of California, Davis, wia shi dey tich Cinema an Digital Media.