Brain Jotter
Chukwuebuka Emmanuel Amuzie (wey dem bon for 5 February 1996), wey plenti pipul sabi wel-wel as Brain Jotter, na easy and transparent. Nigerian komedian, content creator, social media influencer and pesin wey dey hep pipul.
Hau e tek stat life and go skul
[chenj-am | chenj-am for orijin]Brain Jotter wey dem bon on 5 February 1996 for Orile Iganmu, insaid Lagos State, Nigeria. E kom fom Imo State originali. Na for Lagos e gro, and na dia e finish both im primari and sekondri school. Leta, Brain Jotter go University of Lagos go stodi Business Administration, and e graduate for 2024.
Hau e tek wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]Brain Jotter stat to du komedi fom wen e stil dey sekondri school, wia e dey paform as stand-up komedian for difrwn live shos. Som of di earli shos wey e paform na “The Unleashed” and “Pencil Unbroken” for Abuja.
But na for 2020 e blo wel wel wen e stat to post shot funny videos for Instagram.
Som of im skits don feature oda popular Nigerian komedians like Mr Funny (Sabinus), Nons Miraj (Ada Jesus), Don Jazzy, and Bovi.
E stil be brand ambassador for The Shawn Exchange, one kompini wey dey du biznes wit digital moni and cryptocurrency.
Brain Jotter evun stat di ‘Gwo Gwo’ dans chalenj, wey later go popula for social media. Na dis chalenj mek pipul rememba one old song “Ka Esi Le Onye Isi Oche” by Mike Ejeagha. For May 2024, Brain Jotter organize one big comedy show for Abuja wey e call “Outside Box Comedy Show.” Som of di earli shos wey e paform. na “The Unleashed” and “Pencil Unbroken” for Abuja.
But na for 2020 e blo wel wel wen e stat to post shot funny videos for Instagram.
Som of im skits don feature oda popula Nigerian komedians like Mr Funny (Sabinus), Nons Miraj (Ada Jesus), Don Jazzy, and Bovi.
E stil be brand ambassador for The Shawn Exchange, du one wit digital moni and
For May 2024, Brain Jotter organize one big comedy show for Abuja wey e kol "Outside Box Comedy Show.”
Leta for November 2024, e parfom as di main pesin for one stej play for Ghana National Theatre. The play nem na “U Play Me, I Play U,” wey Efo Kodjo Mawugbe rait.
E don olso akt for plenti komedi series lik Basketmouth’s Papa Benji.
How e tek dey help pipul
[chenj-am | chenj-am for orijin]Brain Jotter don get plenti recognishon bikos of how e dey hep pipul. For 2023, e hep raise awareness for one wuman wey nid surgery. Pipul kom donate moni til dem fit pay for ha hospital treatment. wuman wey no fit waka wel (disabled) tok ha stori, and di crowd join bodi donate over ₦20 million giv ha di tin chenj ha laif.
Afta di “Gwo Gwo Gwo Ngwo” chalenj blo everiwia, Brain Jotter visit di old-time highlife legend Mike Ejeagha, kom giv am ₦2 million as sopot.
For 2025, Brain Jotter travu go Sierra Leone for one big sho wey dem kol Eco-fest, wey hapun for Freetown, do capital city. Na dia, e meet plenti Sierra Leone supastars.
Stil for 2025, e push im helpin hand mata go anoda levu wen e launch one online platform wey e kol “Share the Grace.” Di website dey hep poor pipul apply for financial hep for tins lik health, skul, and smol biznes, so dat helpin pipul go eazi and klear.