Bola Agbaje
Bola Agbaje na wuman wey dey rait drama. Dem bon am for St Thomas' Hospital wey dey Waterloo for London. Ha papa na pesin wey dey wok for govment (civil servant), an ha mama dey cook for wok. Shi gro for North Peckham Estate. Fom wen shi bi six yias old til shi rish eight, shi folo dem go Naija smol bifor shi kom London bak.
Shi stat to len akting for one skul wey dem dey kol Identity Drama Skul, but shi no finish. Instead, shi go join Royal Court Theatre Young Writers Programme, wey dey tich pipu how to rait drama wel.
Wetin shi dey rait abaut
[chenj-am | chenj-am for orijin]Bifor-bifor, Agbaje bi aktress. But nau, shi dey rait pleys wey dey tok abaut how African pipu dey liv for England an for oda plez. Ha stori dey tok abaut how African pipu dey trai chenj insaide society an di wahala wey dey insaide dia community. Shi dey holso sho di wahala wey fit dey for difren races an tribes.
Som of ha pleys wey pipu sabi wel wel na Gone Too Far! an Belong. Dis pleys dey tok abaut how pipu dey get wahala wit identity and kolsho.
Wetin dem sabi ha for pas
[chenj-am | chenj-am for orijin]Ha fest pley Gone Too Far! first show for Royal Court Theatre for London. The play win one big award wey dem kol Laurence Olivier Award for 2008. Leta, dem stil sho am again for Albany Theatre an Hackney Empire, even though e no last too long.
Shi stil rait oda plays lik The Burial and Belong.
For 2018, dem chuz Agbaje as one of the pipu wey bi Fellow for Royal Society of Literature (RSL). Na speshial awod wey dem give ha, an shi bi one of di 40 pipu wey dem chuz wey neva rish 40 years old. Di reason wey dem du dis one na to hep balance how dem dey giv di awod bifor.
Bola Agbaje FRSL get Nigerian papa and mama.