Jump to content

Blackface Naija

From Wikipedia

Ahmedu Augustine Obiabo wey pipo sabi wel wel as Blackface Naija or jos Blackface na Naija Singa, an song-raita. Pipo no am as di pesin wey join 2face rait di song "African Kween". African Kween na song wey 2face leta sing an wey popula wel wel in an outside Naija.

Plantashun Boyz

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Blackface de inside di pipo wey start di grup kol Plantashun Boyz in 2000. Di oda pipo for di grup na 2Baba an Faze (Chibuzor Oji). Na Blackface an 2Baba fest start di grup dorin di time wey dem de sekondri skul for Benue. Na leta leta Faze kom join dem wey dem go sing for Enugu. Plantashun Boyz rilis two habom wey popula wel wel. Di two habom na: Body and Soul (2000) an di sekod na: Sold Out (2003). Di grup skata in 2004, an dey leta kom back togeda in 2007. Wen dem kom back in 2007, dem rilis one habom wey di tahitu na: Plan B. Blackface stil bi frend wit Faze, e no like 2face at all bikos of kwurel wey de for African Kween.

As onli im tek start to sing

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Afta dia grup Plantashun Boyz skata in 2004, Blackface kontiniu to dey sing. E rilis one hip hop habom in May 2004 wey get di tahitu Ghetto Child. For di habom, Blackface kol oda muzishan to join am sing for dat im habom. Di habom get one song wey bi Hard Life an Alabai join sing for dat song. Blackface also mek anoda habom for im gang wey e form D Tribunal an im kol di habom What We Are. Afta Blackface rilis Ghetto Child, e rilis Evergreen, Jungle Fever, Me, Musiq and I, Dancehall Business, an di Prospective Defender.

E pasonal life

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Blackface wife na Dayo. Di marej produs two pikin Caroline an Alex. Di marej las for onli Eight years as both Blackface an Dayo hagri to sepiret bifor kot go finali skata di marej.