Bisi Adeleye-Fayemi
Bisi Adeleye-Fayemi na Nigerian-British woman wey dey fight for women right, dey hep govmet mek beta lor, an dey do wok wey go mek society beta. Shi bi raita too.
Shi bi bifor bofor fest Lady for Ekiti State, as shi mari Govnor Kayode Fayemi. Shi bi First Lady from 2010 go rish 2014, kom stil do am again fom 2018 go rish 2022.
Na shi stat Above Whispers Media Foundation an shi dey rait one everi-week article wey dem dey kol Loud Whispers for Abovewhispers.com. Shi stil stat one mentoring program wey dem kol The Wrapper Network, wey dey hep women. Shi don wok wit UN Women Nigeria as Senior Adviser (2017–2018), an shi stil bi Visiting Senior Research Fellow for Africa Leadership Center, King’s College, London.
Edukeshon
[chenj-am | chenj-am for orijin]Shi go skul for University of Ife (wey dem leta chenj di nem to Obafemi Awolowo University) for Nigeria, wia shi get BA (1984) an MA (1988) for History. Shi stil go Middlesex University for UK go stodi Gender and Society (1992).
Wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]Fom 1991 go rish 2001, shi bi Dairekto for one organisation wey dey faight for African women wey dem dey kol Akina Mama wa Afrika (AMwA). Di ofis dey London and Kampala.
Shi stat one leadership skul for Afrika women wey dem dey kol African Women’s Leadership Institute. Shi stil co-found African Women’s Development Fund (AWDF) for Ghana, wey dey give money to women organisations, an shi bi di first CEO fom 2001 go reach 2010.
Shi don sarf for plenti organisations lik:
.Comic Relief (UK) as Trustee (1998–2001)
.International Network of Women’s Funds as co-Chair (2004–2006)
.Association for Women’s Rights in Development (AWID) as Honorary President (2003–2005)
.Women’s Funding Network as board member (2009–2012)
.African Philanthropy Network (wey dem first kolAfrican Grantmakers Network) as one of di founders for 2009
.Shi hep stat African Feminist Forum for 2006
.As First Lady, shi uze ha position tek faight for beta lor an policy wey go help women an girls. Shi gather difren piou wey fit sopot dis kain wok.
Shi faight mek dem pas plenti laws lik:
.Gender Based Violence Prohibition Law (GBV Law) for 2011 (wey dem revise for 2019)
.Equal Opportunities Bill (2013)
.HIV Anti-Stigma Bill (2014)
.Law to Protect Minors Wey Dem Don Abuse Sexually (2020)
.Ekiti State Mental Health Law (2021)
.Ekiti State Gender Composition Law (2022)
.Multiple Births Trust Fund (2022)
.She bi Chair for Ekiti State GBV Management Committee and Ekiti State AIDS Control Agency.
.Fom 2019 go reach 2022, shi bi Chair for Nigerian Governors’ Wives Forum (NGWF), wey uze dia pawa tek protet wuman and children.
.For 2020, NGWF hep Nigeria Governors Forum declare State of Emergency against Gender-Based Violence during COVID-19 pandemic.
.Shi dey rait stories, an one of ha stories na abaut one great Yoruba wuman Moremi Ajasoro.
Awods an Recognition
[chenj-am | chenj-am for orijin].December 2021: National Network of NGOs for Nigeria nem ha as one of di 100 most influential civil society leaders for Nigeria.
.March 2022: United Nations Development Program Nigeria, UN Women Nigeria, European Union delegation, an British High Commission giv her Outstanding Woman Leader Award.
.November 2022: African Philanthropy Network giv ha Lifetime Achievement Award.
Buks wey shi don rait
[chenj-am | chenj-am for orijin]Bisi Adeleye-Fayemi don write plenti buks, lik:
.Speaking for Myself (2013)
.Speaking Above a Whisper (2013) (her life story)
.Loud Whispers (2017)
.Where is Your Wrapper? (2020)
.Demand and Supply (2023)
.A Tray of Locust Beans (2023)
.Shi stil co-edit Voice, Power and Soul (2008)
Parsonal life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Shi mari Kayode Fayemi, wey bi Govnor of Ekiti State for 2010 an again for 2018. Dem meet wen dem bi students, an dem get one pikin togeda, Folajimi Fayemi, wey bon for 1994.