Biodun Stephen
Biodun Stephen na pesin wey sabi do fim for Nigeria. E sabi dairect, rait, an produs fim, especiallyromanc an komedi. Meni of im fim title dey kom fom di nem of di main character for di stori. Ezampu na Tiwa's Baggage, Ovy's Voice, Ehi's Bitters, an Sobi's Mystic.
Pasonal life an edukeshon
[chenj-am | chenj-am for orijin]Biodun Stephen don mari. Shi go Obafemi Awolowo University wia shi stodi philosophy. After dat, shi go London Film Academy go len beta way to produs fim.
Wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]Biodun Stephen stat ha fim wok for 2014 wit di film The Visit. Pipu praise di fim bikos e get smol cast, but di stori mek sense wel. Di fim even kolet two nominations for 2016 Africa Magic Viewers Choice Awards.
For one interview, shi tok say aktin na ha first love, but e no wok out well, so shi go len niu skills. Shi say shi dey do fim bikos shi wan uze am pass mesej to di wod.
For 2017, ha fim Picture Perfect kolet five nominashon an win two awods for di Best of Nollywood Awards. Shi win Best Director for di 2016 Maya Awards (Africa).
Shi tok say shi dey get inspiration for ha love storis fom ha own experience, wetin don hapun for ha laife, an wetin shi don ci pipu around ha dey fez. For For ha fim Tiwa’s Baggage, shi get nomination for Best Director for di 2018 City People Movie Awards.
For 2018, Seven an Half Dates na one of di fim wey Guardian rekomend mek pipu watch dat weekend. Shi tok say one of di biggest moments for ha wok na wen she collect AMVCA nominashon, bikos e giv ha confidence to kontinue di wok. Shi menshon say pipu lik Emem Isong an Mary Njoku dey inspire ha for di fim industry.
Apat fom film, shi dey do radio sho wey dem dey kol Whispers everi weekend.
List of ha fims
[chenj-am | chenj-am for orijin]Shi don dairect, rait, an produs meni fims, lik: .The Visit (2015) – E get two AMVCA nominations.
.Picture Perfect (2016) – E win two awards for Best of Nollywood Awards.
.Tiwa’s Baggage (2017) – E get nomination for Best Director for City People Movie Awards.
.Ovy’s Voice (2017)
.Seven and Half Dates (2018)
.Ehi’s Bitters (2018)
.Looking for Baami (2019)
.Breaded Life (2021) – E get AMVCA nomination for Best Movie West Africa.
.Aki and Pawpaw (2022)
.Sista (2023)
.Muri & Ko (2024)
.Awards and Nominations .2022 AMVCA – Introducing the Kujus win Best Writer.
.2022 AMVCA – Breaded Life get nomination for Best Movie West Africa.