Bilikisu Funtuwa
Hajiya Bilkisu Salisu Ahmed Funtuwa na one Naija raita. Shi dey rait novel for Hausa an dey tok abaut Muslim wuman. Na one of di most popula raita for wetin dem dey kol "Kano market literature" or Littattafan Soyayya, wey mean "books of love".
Ha buks dey mix tok abaut wuman right an feminism wit Hausa tradishon an Islam. Shi dey uze ha own experience as Hausa wuman an Muslim tek rait ha stories. Shi sabi sey for Hausa kolsho, meni wuman dey mari for polygamy an society get som kain expectashon for dem. So shi dey rait abaut how wuman fit handle dis kain life.
For ha stories, di main character na wuman wey uze edukeshon an religion tek mek dia laife beta. Dem go skul, get beta wok lik lorya, doktor, an govment offishial, an stil mari rish man wey lov an respet dem. One big topic wey shi dey holways rait abaut na strong lov, wia hosband an wife dey enjoi demself, get respet for each other, and liv hapi life.
Apat fom woman wey dey trai get kontrol for dia famili, ha buks dey encourage Muslim woman mek dem pursue edukeshon wel an stil kip dia faith strong.
Hajiya Bilkisu Funtuwa dey liv wit ha famili for Funtua, Katsina State, Nigeria.
Buks wey shi don rait
[chenj-am | chenj-am for orijin].1994: Allura Cikin Ruwa (Needle in a Haystack)
.1996: Wa Ya San Gobe (Who Knows Wetin Go Happen Tomorrow?)