Jump to content

Bibi Bakare-Yusuf

From Wikipedia

Bibi Bakare-Yusuf na Naija wuman wey dem travu go England. For dia, shi go university wey dem dey kol Goldsmith College for London, wia shi stodi Communication an Anthropology. Leta, shi do PhD for Gender Studies for University of Warwick.

How shi tek stat Cassava Republic Press

[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 2006, Bakare-Yusuf, wey bi academic for UK an Nigeria dat taime, join hand wit Jeremy Weate tek stat Cassava Republic Press. Dem stat am for Abuja bikos dem wan mek African buks dey cheap, develop lokal raitas, an mek African stories no just dey popular for Europe an America onli.

Bakare-Yusuf tok sey shi no sabi anytin abaut publishing bifor shi stat:

"I no sabi anything about book business. I just sabi read an rait. But I wan mek African pipu dey read Afrika stories, an I wan make dem begin question who dem bi an how society dey wok."

Shi explain wai shi chuz di nem Cassava Republic Press:

publishing hauz connect Africa wit itself an wit Afrika pipu wey dey for oda kontries. 'Republic' mean say we dey stat something niu, we dey build our own pawa."

Wai shi stat di poblishing biznes=

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Bakare-Yusuf biliv sey Afrikas no supos jos dey rait buks; dem supose get the pawa to poblish dia own stories too. Shi tok sey:

"We stat Cassava Repoblic bikos we wan mek Afrikas kontrol how dem dey tel dia own stories, no be say na only oyinbo pipu go dey poblish and own our buks."

Cassava Republic Press don poblish meni African raiters, wit pipu lik Lola Shoneyin, Teju Cole, Helon Habila, Adaobi Tricia Nwaubani, an Chigozie Obioma. Dem dey poblish difren kaind of buks—literary fiction, crime storis, chudren buks, an even buks wey dem uze for school curriculum for Nigeria.

For 2014, Cassava Republic stat Ankara Press, wey stories wey no folo di old stereotype wey mek men dey kontrol women. Shi tok sey:

"We wan ci African lov stories wey go sho Afrika women as strong pipu, wey go mek dem ci di best version of demsef for buk."

Ha wok for human rights

[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 2016, Bakare-Yusuf stat one NGO wey dem dey kol The Initiative for Equal Rights (TIERS). Di organization dey wok to protect di human rights of minority grups for Nigeria an West Africa.

Awods an recognition

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Bakare-Yusuf don kolet plenti awods bikos of her contribushon to African literature an publishing. Som of dem na:

.Keynote speaker for Abantu Book Festival for Soweto, South Africa, for 2018. .Honorary Fellow of the Royal Society of Literature for 2019. .ASAUK "Distinguished Africanist" awod for 2020, bikos of the work wey she don do for African studies.

Wia dem gada di tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]