Jump to content

Biawacheeitchist

From Wikipedia

Bíawacheeitchish (1806 – 1854),[1] wey dem dey kol Woman Chief for English, na one big pesin and faita from di Crow pipul. From wen shi smol, shi laik to du tins wey mostli na men dey du. Shi leta bikom one of di most impotant lidas for di Crow pipul. Shi ivun join di Council of Chiefs, wey be grup of ol di big lidas, and shi bi nomba three for rank. Meni pipul from di white man land wey visit di area hie abaut ha. Som pipul ivun tok say shi fit bi di sem pesin wey James Beckwourth tok abaut as "Pine Leaf", bot som pipul no shwo say di tori koret.

Tori about ha laif

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Woman Chief na Gros Ventre pesin wen dem bon ha, bot nobodi sabi ha ril nem. Wen shi bi araund 10 yias old, Crow worios kom atak ha pipul and kari ha go. One Crow faita kom adopt ha and rez ha laik im pikin. Bikos e no get boi-pikin again, e sopot ha to du man wok.

Shi sabi ride horse wel-wel, shi sabi shut gon, and shi sabi kot and pripa buffalo afta hont. Ivun dou shi dey du men tins, shi stil dey wie wuman klots. Wen ha papa wey adopt ha kpai, shi kom tek over im haus and lidaship.[2][3]

One taim, Blackfoot pipul kom atak one fort wey Crow pipul and som white familis dey haid. Woman Chief fait bak strong and help chez di enemis komot. Afta dat, shi gada ha own grup of worios and atak Blackfoot vilejis. Dem kari plenti horses and kut enemis hed as sain of vitri.

Bikos of ol dis tins wey shu du, dem mek ha chif for ha own pipul and giv ha di nem Bíawacheeitchish—wey min Wuman Chif. Shi be nomba three for di Council of Chiefs wey get 160 lidas.

Shi mari four waifs. Dat one mek her haus get more respet and moni. After di 1851 peace treaty for Fort Laramie, shi wok for pis bitwin ha pipul and oda pipul for Upper Missouri. Shi ivun mek pis wit her old pipul—di Gros Ventre. Bot afta some yias, for 1854, som Gros Ventre worios ambush ha and kil ha.[2][4]

Som white visitos laik Edwin Denig and Rudolph Kurz rait abaut Woman Chief. Dem si ha as speshial wuman among di Crow pipul wey men dey rul. Dem kompia ha to Amazons from Europe tori. Bot meni of dem tori get wahala, bikos dem rait wit bias (dem no rili ondastand ha kolsho), ivun dou wi stil len smol from dem.[5]

One man wey im nem bi James Beckwourth rait say e mit one Crow warrior wuman wey ha nem bi Bar-chee-am-pe, wey pipul dey kol Pine Leaf. Som tins wey e tok mach Woman Chief tori, bot meni pipul biliv say im own tori get tu moch shuga—e ova-tok am or ivun lai. E say Pine Leaf tok say shi go kil 100 enemis bifor shi go mari. E olso tok say e laik ha and ivun ask to mari ha. Bot som pipul, laik Bernard DeVoto, say Beckwourth no tu dey tel tru wen e kom to kauntin, lov tori, and enitin abaut imself.

No bi onli Woman Chief dey. Crow pipul stil get oda wuman worios laik Akkeekaahuush (Comes Toward The Near Bank, 1810 – 1880) and Biliíche Héeleelash (Among The Willows, 1837 – 1912). Di sekond one na big war lida wey dey kari sakred pipe.[6]

Wia dem gada di tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  1. Sonneborn, Liz (2014-05-14). A to Z of American Indian Women. Infobase Publishing. pp. 275–276. ISBN 978-1-4381-0788-2.
  2. 1 2 Edwin T. Denig: Five Indian Tribes at the Upper Missouri, University of Oklahoma Press, Norman, 1961, p. 195–200
  3. Jenkins, Jennifer L. (2001). Bataille, Gretchen M.; Lisa, Laurie (eds.). Woman Chief. Native American Women: A Biographical Dictionary. Routledge. p. 341. ISBN 1135955875. Retrieved 2025-04-20.
  4. Jenkins, Jennifer L. (2001). Bataille, Gretchen M.; Lisa, Laurie (eds.). Woman Chief. Native American Women: A Biographical Dictionary. Routledge. p. 342. ISBN 1135955875. Retrieved 2025-04-20.
  5. Roscoe, Will (1988). Roscoe, Will (ed.). Strange Country, This: Images of Berdaches and Warrior Women. Living the Spirit. MacMillan. p. 69. ISBN 031230224X. Retrieved 2025-04-20.
  6. "Little Bighorn College - Timeline of Apsáalooke Chiefs and Women Leaders from the Buffalo Days". Archived from the original on 2023-12-05. Retrieved 2025-04-29.