Betty Irabor
Betty Irabor (dem bon am on March 25, 1957) na Nigerian raita, poblisha, an pesin wey dey do charity wok. Shi bi di person wey stat Genevieve Magazine, an bifor bifor, shi get one column for Black & Beauty magazine for UK. Shi stil get one foundation wey dey hep pipu sabi abaut breast cancer, how to catch am quick, an how to treat am.
Ha wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]For 2003, shi stat Genevieve Magazine, wey dem dey kol Nigeria nomba one inspirational an lifestyle magazine. Di magazine dey for Lekki an e get 14 workas. Dem dey poblish 10 issues evri year, an di website dey giv celebrity gist. Shi bi di editor-in-chief an di CEO of di magazine.
For 2018, shi rait ha life stori for one buk wey dem kol Dust to Dew, wia shi tok abaut di wahala wey shi fez wit depression.
Shi stil dey do plenti charity wok. Shi bi poblic spika an shi get Genevieve PinkBall Foundation, wey dey fight breast cancer.
Ha pasonal life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Betty Irabor na Nigerian wuman, dem bon am on March 25, 1957. Shi mari Soni Irabor, an dey get two children. Dia pikin do one shot fim wey dem selet for Zanzibar International Fim Festival.
Awods an honor
[chenj-am | chenj-am for orijin]For 2011, di Association of Professional Women Bankers giv ha awod as di most successful female poblisha for Nigeria.