Bessie Jones

From Wikipedia
Bessie Jones
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromAmerika Chenj-am
Fest nemBessie, Mary, Elizabeth Chenj-am
Famili nemJones Chenj-am
Wen dem bon am8 February 1902 Chenj-am
Ples wey dem bon amSmithville Chenj-am
Wen e kpai17 July 1984, 4 September 1984 Chenj-am
Place of deathBrunswick Chenj-am
Manner of deathnatural causes Chenj-am
Cause of deathleukemia Chenj-am
Wok wey e dey dusinga, traditional folk singer Chenj-am
Instrumentvoice Chenj-am
Stai of song abi fimGospel, traditional folk music Chenj-am

Mary Elizabeth Jones (dem bon am February 8, 1902 an e kpai in July 17, 1984) na America gospel an tradishonal singa wey pipul sabi as singa wey hep men pipul like tradishonal song, games an tori in di 20 senturi.Wen Alan Lomax fest mit am, e tok sey "Jones rili wan tish America pipul from e heart. Alan Lomax too sey e kol Jones di mama konrej of Amerika Blak tradishon.

How e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Jones gro up in a smol blak famin komuniti in Dawson, Georgia. Jones famili poor but dey like muzik wel wel. E grapapa wey bi slave wey dey bon in Afrika dey always dey tish Jones di kind song wey e dey sing wen e dey wok inside farm. Jones no go skul again wen e rish ten years old an by di time wey Jones go rish 12 years, e don mari an bon pikin. Jones hosband Cassius kpai afta some years wey dey don mari. In 1924, Jones leave e 10 years old pikin wit e famili memba-dem an waka go Florida. For Florida, e stat to dey du all dose smol skol wok, dey play kard an sel ogogoro. Jones leta get e sekod hosband an stey wit am for St. Simon Island an kom join di Georgia Sea Hiland Singa E dey hungri Jones mek Afrika-Amerika histri no jos kpai like dat. E wan yuz song an dans tek save di Afrika-Amerika histri. Dis one mek am travul go New York Siti in 1961. For New York e jam Lomax so dat Lomax fit rekod e life tori an di bodi of muzik wey e get. Jones an di grup "Georgia Sea Hiland Singa" travul an dey sing in di 1960s. Dey sing for Carnegie Hall, [[Central Park| Sentral Pak, di Smithsonian Institution folklore festivals, di Newport Folk Festival an di Monterey Folk Festival on May 18 to 19, 1963. Jones kolet meni awod for tradishonal muzik an e inklud National Endowment for the Arts National Heritage Fellowship in 1982 an di Duke Ellington Fellowship at Yale Yunivasiti.