Jump to content

Bello Turji

From Wikipedia

Bello Turji Kachalla (dey bon am in 1994) wey bi sabi wel wel as Turji na Naija pesin wey bi di lida of group-dem wey dey kili-kili for Naija. Dis pipo-dem dey do dia bad tins in di Norta-Westa aria of Naija like Zamfara Stet, Sokoto Stet an Niger Stet. For 2022, Turji gang do plenti kili-kili of pipo for Zamfara. Dis kilin rish 200 pipo. Smol smol pikin-dem an wumen folo kpai for dis opureshon wey Turji bad gang do.

How im tek start life

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Shinkafi Lokal Govamet wey de Zamfara Stet, Naija dem bon Turji. E na Fulani. Turji no go skul but e fit te-kia of cow wel wel. Turji tok sey one group wey dia nem na Yan Sakai tif some of im cow as di group stil kpai six of im brodas-dem. Yan Sakai na one group for Zamfara wey dey helep do siki-o-riti for di stet. Turji tok sey e papa wan kari di Emir of Zurmi go kot ( na di Emir dem give di cow wey dem tif from Turji) but di plan no work. E stil tok sey di sem Emir of Zurmi kpai im onku. Wen Turji dey tok to Daily Trust Niuz-pepa, e tok sey na dis tins mek am kari gun an dey killl pipo. Pipo no Turji to bi di pesin wey dey kari out di kili-kili of pipo an di polis an harmi in di North-West rijion of Naija.

For September 2021, di Yan Sakai vigilate group enta one mosque wey de Gwadabawa kilin eleven pipo. Dis one mek Turji vex kari im boiz enta Goronyo maket in Sokoto to kill 50 to 60 pipo. Turji an im boiz in December 2021 stop one motor an put faya inside di motor. Dis faya kill all di pasenja wey de inside di motor an 30 pipo kpai inside dis tins wey Turji an im boiz do.

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Pipo dey tok sey Turji get koneshon with Dr. Bello Matawalle. Bello Matawalle bi di forma Zamfara Stet gofnor an im stil bi di kolrent minista of Stet for Difens in di Ahmed Tinubu hadministrashon.

Pipo tok sey Turji tok sey im an oda bad pipo-dem kolet 34 niu hilux motor from di gofnor in 2019.