Bekeme Masade
| Man abi wuman | wuman |
|---|---|
| Kontri wey e kom from | Naija |
| Nem for lokal langwej | Bekeme Masade |
| Orijina nem | Ilobekeme Chikodili Masade |
| Wen dem bon am | 19 August 1982 |
| Ples wey dem bon am | Lagos |
| Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, Naijá langwej |
| Wok wey e dey du | entrepreneur, raita |
| Wie e go skul | University of Lagos, Queen Mary University of London |
Bekeme Masade-Olowola na Nigerian wey dey du biznes wey go hep society. Shi bi memba for Board of Directors for Global Reporting Initiative (GRI) – na di biggest organization wey dey chek how kompanies dey afet di environment and kommuniti – ad shi bi Chief Executive for CSR-in-Action, one grup wey join consulting kompani, idea pipu (think tank), an training skul wey dey focus on how kompanies fit du beta for society, hep govment mek beta policy, tok for pipu mata, empower wuman an youth, an promote development wey go last for long taime.
Ha life tori
[chenj-am | chenj-am for orijin]Bekeme Masade-Olowola gro for Lagos. Shi go University of Lagos wia shi stodi English an graduate for 2004 wit Sekond Class Upper. For January 2008, dem selet her as one of di 18 yung professionals fom Africa an di Diaspora wey participate for The Apprentice Africa reality show.
As pesin wey dey du biznes wey go hep society, shi bi Chief Executive for CSR-in-Action, one platform wey dey bring pipu togeda for biznes an advis kompanies on how dem fit do beta for society. Shi dey focus on how kompanies fit hep wuman dem an youth, an how developmet go last for future. Sins 2011, under her leadership, CSR-in-Action don hep kompanies for Nigeria use di GRI method to measure an report how dem dey afet di environment an society. Dem don hep promote transparency for biznes wit training, advice, an campaigns.
For March 2012, CSR-in-Action poblish di first sustainability investment report for Nigeria The Collective Social Report: Nigeria (wey dem later chenj to The Corporate Sustainable Investor Report). Di report wey United Nations Framework Convention on Climate Change (UNFCCC) an United Nations Global Compact (UNGC) sopot, rate how kompanies dey behave for environment an society. For 2013, dem introdus ranking wey dey sho how kompanies tek serius wit di mata of sustainability. By 2014, CSR-in-Action don dey wok to mek sure di mineral resources wey fit reach $100 billion for Nigeria go benefit everibodi.
Masade-Olowola hep stat Business Coalition for Sustainable Development Nigeria (BCSDN) for May 2014. Di organization join hand with di World Business Council for Sustainable Development (WBCSD) to bring difren big kompanies togeda to wok for beta development for di kontri.
Shi stil dey insaide board for difren non-profit an biznes organizashons. Shi be di organizer of Sustainability in di Extractive Industries Conference—di biggest event wey dey focus on how extractive industries (like oil an mining) fit du tins wey go benefit di piouy. Shi stil bi di produsa of The Good Citizen Radio Show, wey dey tich piou how dem fit be beta citizens.
Awods
[chenj-am | chenj-am for orijin]Shi get merit for International Human Resource Management & Employment Relations (MSc) fom Queen Mary University of London.
For 2013, di Global Reporting Initiative for Amsterdam nem ha wok as one of di top 10 designs for di Next Generation Competishon.