Bayo Onanuga
Bayo Onanuga (dey bon am 20 June 1957) na Naija jornalist. Na Onanuga bi di fonda of The News Magazine. Forma presidor Muhammadu Buhari chuz am as di Manejin Jeneral of di News Agency of Nigeria. Bifor Onanuga bikom di Manejin Daretor of News Agency of Nigeria, e don do CEO for PM News an Manejin Daretor for The NEWS Magazine.
How im tek start life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Dem bon Onanuga inside di famili of Anikilaya wey de Ijebu Ode, Ogun Stet. Onanuga go Muslim Kolej Ijebu for im pamari an sekondiri skul edukeshon in Ode. Na for 1974 e finish from Muslim Kolej Ijebu. Onanuga enta Fediral Govamet Kolej, Odogbolu in 1975 an finish di skul in 1977. Onanuga enta Yunivasiti of Legos to go rid Mass Komunikeshon in 1977 an finish di Yunivasiti in 1980. Onanuga kom work for OGTVA (Ogun State Television Authority) for one an half years. E leta join printin jornalis wie e tek work for The Guardian. Onanuga komot from The Guardian to go start im own niuz-pepa The Weekly Titbits. In 1985, Onanuga join The National Concord as senior Editor. Wen e de Concord, Onanuga togeda with Seye Kehinde, Dapo Olorunyomi, Babafemi Ojudu, Kunle Ajibade bikom Chief Editor in Africa Concord. Na Seye Kehinde get di City People Magazine, Dapo Olorunyomi na editor for Premium Times, Kunle Ajibade na Chief editor for PM NEWS. All dis pipo kom togeda to form The News Magazine in 1993.
How im tek put bodi for politis
[chenj-am | chenj-am for orijin]Wen Solja stil dey kontrol Naija dorin Sani Abacha time, di SSS (State Security Service) hold Onanuga for Legos for som times. E leta japa komot for Naija go hid for oyinbo kontri. Afta Sani Abacha kpai, Onanuga komot bak to Naija in 1997. In 2019, Onanuga tok sey im wan yuz APC (All Progressive Congress) kampain for di post of Sinetor posishon for Ogun East district in di 2023 jeneral eleshon.