Barbara Benary

From Wikipedia

Barbara Benary (dem bon am for April 7, 1946 an e kpai for March 17, 2019) na Amerika komposa an pesin wey dey stodi hiw difren difren kolshor dey mek muzik. Na muzik wey kom Indonesian an Indian e dey chuk eyes pass. Benary don mek muzik for meni kompani wwy du mek fim for stage like La Mama Esperimental Tihata Klub in di 1970s. Benary stil mek song for ETC Kompani of La Mama's sisin prodorshon Di onli jelosi of Emer wey dey du in di 1970s an La Mama's East Vilej tihata as dey dey sho am evri wie dey go. Benary mek muzik for Gauntlet or the moon on fire wey John Braswell rait an daret in 1976. Na for 1976, Benary wit Phillip Corner an Daniel Goode fom Gamelan Son of Lion. Na Benary mek most of di band instrumental. Benary pafom wit Gamelan Son of Lion for di prodorshon wey di nem na "1001 instruments You've Never Seen or Heard" for La Mama in 1979. Benary mejo wok inklud Shadow puppet Operas wey get di nem Karna an "The Story Esther"