Jump to content

Balaraba Ramat Yakubu

From Wikipedia

Balaraba Ramat Yakubu (wey dem bon on 1959) na one Nigerian raita wey dey rait for Hausa langwej. Shi bi one of di big pesin for di type of Hausa lov stori wey dem dey kol littattafan soyayya. No bi plenti Hausa raitas get di chanz to translate dia book enta English, but shi bi one of di few wey don get dat opportuniti. She stil bi pesin wey dey rait fim, produs am, an diaret Kannywood fim. Ha stori dey tok abaut important mata lik marej wey dem fors pesin do an di importance of edukeshon for wumen dem.

How shi tek stat life

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Balaraba Ramat Yakubu na di yunga sista of General Murtala Ramat Muhammed, wey bi Nigeria military ruler fom 1975, bifor dem kil am for 1976.

Wen shi bi 13 years old, dem kari am komot for school an fors am mek shi mari earli. Na dis experience mek shi decide sey shi go dey rait for Hausa instead of English.

How shi tek stat ha wok

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Shi stat her raitin wok as di only wuman for one big raiters' klub for Kano wey dem dey kol Raina Kama. Ha first buk Budurwar Zuciya ("Young at Heart") kom out for 1987.

Afta dat, shi rait:

Alhaki Kwikwiyo Ne... ("Sin Is a Puppy That Follows You Home") – 1990

Wa zai auri jahila? ("Who Will Marry an Ignorant Woman?") – 1990


Di book Alhaki Kwikwiyo Ne... later turn fim for 1998, wey one dairektor wey dem kol Abdulkareem Muhammed du.

For 2012, one Indian publishing kompini wey dem dey kol Blaft Publications translate di buk Alhaki Kwikwiyo Ne... enter English, an meni pipu enjoi di buk wel wel.

One literary awod wey dem dey giv for Hausa drama, dem nem am afta ha — Balaraba Ramat Yakubu Literature Prize for Hausa Drama.

Balaraba Ramat stat to dey produs fim for 1990s. One of di fim wey shi rait an produs wey get beta nem na Juyin Sarauta, wey win like ten awods an meni scholars plus fim experts tok sey di fim mek sense wel wel.

Som buk wey dem don rait about ha wok

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Kabir, Hajara Muhammad – Northern Women Development (Nigeria). ISBN 978-978-906-469-4. OCLC 890820657.

Wia dem gada tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]