Jump to content

Babalawo

From Wikipedia

'Babaalawo or Babaláwo for West Afrika (babalao for karibian an south Amerika langwej an babalaô in Brazilian Portuguese) wey mins fada of sikret in di Yoruba Langwej. Di nem na nem wey dem dey give pesin wey bi priest of Ifa orakul. Ifa na di sistem wey Orunmila (god) dey tek komuniket with pipo. Orunmila is di god of wisdom an im dey infom pipo of wetin Olodumare (God) tok sey go hapun bifor di tin hapun.

Histri of Babalawo

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di word babalawo na one Yoruba word wey kom Yoruba tradishonal rilijion. Babaláwo na priest or pesin wey dey si vishon yuzin di Ifa sistem in Yoruba kolsho wey de West Afrika. Ifa sistem na one hard an hodin days pratis wey komon for Yoruba tradishonal rilijion. E dey very difikut for pesin to no di orijin of Ifa sistem of komunikeshon. Wetin we no bi sey di sistem do tey wel wel wey do Yoruba pipo don dey yuz am. Na pipo wey dey woship Orunmila dey yuz Ifa sistem bikos dem bilif sey Orunmila bi di god wisdom an vishon. Pipo bilif sey na from Olodumare Orunmila get di sense of Ifa sistem. In Yoruba rilijion, na Olodumare bi di most pawaful an supreme god for all di gods wey dey dis life. Akordin to Yoruba tradishonal rilijion, pipo dey yuz Ifa sistem to if dey wan mek disishon, if pesin wan no im destini an wey pesin dey luk for spirit-shuwal dareshon.

Babalowo bi di priest wey dey dey pipo wetin di Ifa sistem tok an dem dey go met am wen dem wan do serimoni, or wen pesin or komuniti dey find advais. Bifor pesin go fit bi Babalawo, di pesin go nid to train wel wel for a long time. Di pesin go nid to lisin an len from im oga wey get sense as Babalawo. Todey, no bi onli for Naija pipo dey pratis Ifa sistem of komunikeshon but na for eni komuniti wey Yoruba pipo plenti for di hol wold.

Dia work in di Sosa-e-ti

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Pipo bilif sey Babalawo fit tel pipo wetin go hapun to dem wen e yuz Ifa sistem. Di one dey hapun wey di babalowo inta-prit di mini of di chain wey e skata for ground. Di babalawo fit yuz palm nut if e no wan yuz chain patas to inta-print wetin go hapun in fulshon.

Di chai

Dia work in di Sosa-e-ti

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Pipo bilif sey Babalawo fit tel pipo wetin go hapun to dem wen e yuz Ifa sistem. Di one dey hapun wey di babalowo inta-prit di mini of di chain wey e skata for ground. Di babalawo fit yuz palm nut if e no wan yuz chain patas to inta-print wetin go hapun in fulshon.

Di chain or palm nut wey dem dey skata dey always fall ontop on stik tray wey yoruba pipo dey kol opon ifa. Yoruba pipo stil give di chain nem as na opele.

Babalawo stil dey helep king (obas) an shif to ask di gods for dareshon or advais in yoruba land. In some Yoruba aria, dis babalawo-dem stil dey de inside di memba wey dey folo king mek disishon. Dia nem fit chenj from babalawo to Araba or Oluwo Ifa. Hodinari pipo sef fit visit babalawo for dem to ask di gods for advais or dareshon. Dis bihaviho get nem too an di nem na Dafa. UNESCO wey bi one big hoganaseshon too no and hasep Ifa as one of di rilijion of di wold. Dem evu