Jump to content

Babachir Lawal

From Wikipedia
Babachir Lawal
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejBabachir David Lawal Chenj-am
Wen dem bon am2 October 1954 Chenj-am
Fest langwejHausa langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Hausa langwej Chenj-am
Langwej wey e tek rait di wokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey ducivil servant Chenj-am
Post wey e deySecretary to the Government of the Federation Chenj-am
Party wey e dey for politisAll Progressives Congress Chenj-am
E pipulHausa langwej Chenj-am

Babachir David Lawal (dey bon am 2 October 1954) na Naija politisha wey don bi seketiri to di Fediral Govmet fom 2015 go rish 2017. Na forma presidet Muhammadu Buhari chuz am to bi di seketiri on 27 August 2015. For 19 April 2017, Buhari sospen Lawal as di seketiri to Govmet of Fedireshon (SGF) an e rimuv am patapata on 30 October 2017 bikos e chop di monie wey govmet to kip to fit elp pipul wey get fud wahala bikos of wetin Boko Haram dey du for Nort-East.

Hau e tek stat laif an go skul

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Lawal go St. Patrick Pamari Skul wey de Maiduguri an finish in 1969. E kom enta Nigeria Militri Skul wey de Zaria fom 1970 go rish 1974 to go du e sekondri edukeshon. Lawal go Skul of Basic Science, Ahmadu Bello University (ABU) fom 1974 go rish 1975. Lawal stodi Eletrikal Enjinerin for Ahmadu Bello Yunivasiti , wey de Zaria an e koley Bashelor of Enjinerin (Eletrikal) satifiket in 1975.Lawal stodi Eletrikal Enjinerin for Ahmadu Bello Yunivasiti , wey de Zaria an e koley Bashelor of Enjinerin (Eletrikal) satifiket in 1975.

Hau im tek wok

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Delta Steel kompini, Ovwian-Aladja e tek stat wok an e rish di posishon of sinior Enjinier. E stat dat wok for 1979 an stop di wok for 1984. Lawal kom go wok for Nigerian External Telecommunications Ltd wey de Legos as dia Prinsipal Enjinier fom 1986 go rish 1989. For dia, e rish di posishon of Rijional Manija. For 1990, Lawal stat im kompini Rholavision Engineering Ltd for Kadun. E de im kompini ontil dey chuz am as di seketiri to di Govmet of di Fedireshon on 27 August 2015. Lawal na memba of Nigeria Sosaeti of Enjinerin, Nigeria Komputa Sosaeti, an Kansul for di Regulation of Enjinerin in Naija.

Hau im tek wok for politis

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Lawal join politis in 2002 wey e join All Nigeria Peoples Party (ANPP). Lawal de plenti posishon for dat parti an na im bi di Deputi kodinetor for Buhari Kampain tim, for Adamawa Stet. For 30, October 2017, Dey rimuv Lawal as di seketiri to Govmet of di Fedireshon bikos of dem sey dem sey mata wey konsain monie wey dey sopos yuz for wahala wey dey hapun. Pipul sey Lawal kari di monie go du anoda tin.