Jump to content

Ayobami Adebayo

From Wikipedia

Ayọ̀bámi Adébáyọ̀ na Nigerian raita wey dem bon for Lagos on 29 January 1988. Smol taime afta shi bon, ha famili waka go Ilesa, leta dem muv go Ile-Ife. Na for Obafemi Awolowo University Staff Quarters shi gro up.

Adébáyọ̀ go Obafemi Awolowo University, wia shi stodi English Literature for first digre (BA) an master’s degree (MA). Leta, shi travu go University of East Anglia for UK, where shi stodi Creative Raitin an dem giv ha International Bursary. Shi don len raiting oder big raiters lik Chimamanda Ngozi Adichie an Margaret Atwood.

For 2015, Financial Times put ha nem insaid di future stars of Nigerian literature.

Ha first buk, Stay With Me, come out for 2017. Meni pipu praise di book, including Michiko Kakutani fom The New York Times, wey tok sey Adébáyọ̀ sabi tel stori wel wel. Di buk win di 9mobile Prize for Literature for 2019 and Prix Les Afriques for 2020. E don dey available for more dan 18 langwej. E even enter shortlist for di Baileys Women's Prize for Fiction, Wellcome Book Prize, an di International Dublin Literary Award.

Ha sekond buk, A Spell of Good Things, kom out for 2023. E tok abaut famili secrets, hope wey no wok out, an how inequality dey affect life. Di buk enta longlist for di 2023 Booker Prize an shortlist for di Dylan Thomas Prize an di 2024 Encore Awod.

Oda wok an Awods

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Apart fom writing buks, Adébáyọ̀ don rait plenti poems an short stories wey dem poblish for difren magazines an anthologies. Shi don also rait articles for Elle UK and BBC. Shi don win men awods, lik:

.2017: The Future Awards Africa (Arts and Culture)

.2019: 9mobile Prize for Literature (Stay With Me)

.2020: Prix Les Afriques (Stay With Me)

.2023: Longlist for Booker Prize (A Spell of Good Things)

.2024: Shortlist for Dylan Thomas Prize and Encore Prize (A Spell of Good Things)


For 2024, she bi jorj for di Women's Prize for Fiction, an dem annos sey shi go bi jury memba for di 2025 Booker Prize.

Personal life

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Adébáyọ̀ mari Emmanuel Iduma, an dem du wedding for 2020, but na for 2021 dem anous am.

Buks by Ayọ̀bámi Adébáyọ̀

[chenj-am | chenj-am for orijin]

.Stay With Me (2017)

.A Spell of Good Things (2023)

Wia dem gada tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]