Augusta Henriques

From Wikipedia
Augusta Henriques
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromGuinea-Bissau Chenj-am
Wok wey e dey duenvironmentalist Chenj-am
Wu e dey wok forTiniguena Chenj-am
Awod wey e koletRamsar Wetland Conservation Award Chenj-am

Augusta Henriques na Guinea-Bissau wuwan wey dey fight for how beta chenj go fit hapun to envaromet an politis. E na tisha an govamet minista. In 2012, Henriques win di Ramsar Wetland Conservation Awod. (Manijimet). For 1991, Henrique join bodi tek fom di hoganasashon Tiniguena. Dis hoganisashon, govamet pioul no dey put mouth inside wetin dey go on inside di hoganasashon. Tiniguena dey fight for how di envaromet go beta an how komuniti wey de Guinea-Bissau go tek join hand du am.Henriques stil de as one of di fondin advaisa of di "Foundation for Education with Production". Na Patrick Van Rensberg fom dis hoganasashon wey dey helep pipul wey no get moni.

Guinea-Bissau don chuz Henriques mek e go tok for dem in meni intanashonal mitin like International Union for Conservation of Nature (IUCN). E don wok in di Ministri of National Education as Head of Adult Education.