Jump to content

Atinuke

From Wikipedia

Atinuke na Nigerian wuman wey dey rait buk for pikin dem and sabi tel Afrika folktale tori for mouth.

Dem bon am for Ibadan, but na Lagos shi gro with ha papa, mama, an three brodas an sistas. Ha papa na lecturer for university, an ha mama na pesin wey dey chek English buk to koret am. Atinuke papa na Yoruba man.

Atinuke decide sey shi wan go boarding skul for England wen shi dey ten years, an shi stay dia til shi rish thirteen years. Leta, ha papa, mama, an siblings waka go England, an shi kontinue ha sku for poblik skul.

For university, Atinuke stodi English an Commonwealth Literature. Shi get two pikin, an shi dey liv for Wales nau.

How shi tek stat to dey tel an rait tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Atinuke first tel stori for pipu wey dey for England in 1990, wen pesin wey dem biluk for sho no come. Na so shi tek stat ha wok to kolet tori from Afrika an pipu wey kom fom Afrika, den shi go dey tel am for difren festivals an skuls.

In 2005, shi stop to travu bikos of sickness, an na dat taime shi stat to rait ha ferst buk about Anna Hibiscus, one small girl wey dey live for "Amazing Africa."

Atinuke don rait more dan 20 buks for children, an e get plenti wey she uze her own life for Nigeria tek rait. Shi even rait one buk wey tok abaut hol di 55 kontris wey dey Africa. Ha buk "Baby Goes to Market" dey sell for US, UK, plus e get French an Japanese version.

Awods wey shi don win

[chenj-am | chenj-am for orijin]

In 2011, ha buk "Good Luck, Anna Hibiscus!" enta list of best pikin buk for The Horn Book Magazine.

In 2015, "Double Trouble for Anna Hibiscus" enta list of best children buk for Shelf Awareness.

In 2017, "You're Amazing, Anna Hibiscus!" enta Kirkus Reviews’ Best Books for Middle Graders.

In 2018, "Baby Goes to Market" enta Children's Africana Buk Awards’ Best Books for Young Children.

In 2021, "Too Small Tola" enta best children book list for The Horn Book Magazine, School Library Journal, an Shelf Awareness.

In 2022, "Too Small Tola and the Three Fine Girls" still mek am for The Horn Book Magazine best children book list.

Som of ha buks

[chenj-am | chenj-am for orijin]

.Anna Hibiscus Series

.Anna Hibiscus (2010)

.Hooray for Anna Hibiscus! (2010)

.Have Fun, Anna Hibiscus! (2011)

.Welcome Home, Anna Hibiscus! (2012)

.Go Well, Anna Hibiscus! (2014)

.Love from Anna Hibiscus! (2015)

.You're Amazing, Anna Hibiscus! (2016)

.Merry Christmas, Anna Hibiscus! (2023)

.Baby Series

.Baby Goes to Market (2017)

.B Is for Baby (2019)

.Baby, Sleepy Baby (2021)

.No. 1 Car Spotter Series

.The No. 1 Car Spotter (2011)

.The No. 1 Car Spotter and the Firebird (2011)

.The No. 1 Car Spotter and the Car Thieves (2012)

.The No. 1 Car Spotter Goes to School (2014)

.The No. 1 Car Spotter and the Broken Road (2015)

.The No. 1 Car Spotter Fights the Factory (2016)

.Too Small Tola Series

.Too Small Tola (2020)

.Too Small Tola and the Three Fine Girls (2021)

.Too Small Tola Gets Tough (2023)

.Africa, Amazing Africa: Country by Country (2019)

Wia dem gada di tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]