Jump to content

Asase Ya/Afua

From Wikipedia

Asase Ya/Afua (or Asase Yaa, Asaase Yaa, Asaase Afua, Asaase Efua) na di wuman goddess of di Akan pipo wey dey kontro weyda wuman go get belle, weyda love go de, weyda peace go de, weyda pipo go tok true, an weyda plant go grow or e no go grow. Asase Ya/Afua na stil mama of pipo wey don kpai wey pipo stil sabi as Mother Earth or Aberewaa. Asase na di wife of Nyankapon . Nyankapon na di god of hevun. Asase stil bi di gel-pikin of Nyame . Nyame bi di wuman part of di three gods Nyankapon-Nyame-Odomakoma. Na dis three gods mek di evri tin wey de dis yunivas. Asase bon two pikin-dem Bea an Tano. Pipo fit stil kol Bea anoda nem wey bi Bia. Inside some tradishonal tori, Asase stil bon anoda pikin wey di Anansi. Anansi na wayo pesin an e stil bi di step-mama of all di spirishual hi-shif dem. Evun sey Asase get pawa wel wel, e no get eni tempu wey pipo dey go to woship am. Na inside agrikolshora farms wey de Asante an oda pleses wey Akan pipo get farm dem dey yuz woship am. Akan pipo rili respet Asase wel wel. Dem dey sakrifis to Asase with di hope sey e go give dem favor an blesin. Pipo wey Asase dey favor wel wel na di Bono pipo. Di emeji wey dem dey tek repriset Asase Yaa na di emeji of di earth an di emeji wey dem tek dey repriset Asase Afua na di emeji of Venus.

Orijin of di nem

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di meni of di word Asase in Twi langwej na Land. Di meni of di word Ya na sombodi wey dey bon on Thursday. Dis one mins sey na on Thursday dem kreate Asase. Di nem Afua mins sombodi wey dem kreate or bon on Friday. Di koko bi sey, di Asante pipo bilif sey na T. Thursday dey kreate but di Fant e pipo bilif sey na on Friday dem kreate Asase. Dis one kom mek di pipo of Asante an plenti odas Akan pipo dey kol Asase Asase Ya wey mins Earth bon on Thursday an Fante pipo an oda Akan pipo dey kol Asase Asase Efua (Afua) wey mins Earth born of Friday. Di Asante stil no Asase Ya as Aberewaa wey mins wuman wey don old . Anoda nem wey dem tek sabi Asase na Asase bo ne nsie wey min "Earth, creator of di underworld".