Arthur Eze
Arthur Eze (dey bon am 27 November 1948) na Naija biznes-man, billioniha, an enaji ezekutiv. Na Eze bi di CEO of Atlas Oranto Petroleum . E stil bi di pro-shasellor of Peaceland Yunivasiti, Enugu, in Enugu Stet
How im tek start life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Na for Souta-East of Naija Dem tek bon Arthur Eze on 27 November 1948. Eze either Igwe Robert Eze bi di king of Ukpo. Ukpo na one town wey de Dunukofia. Eze na king pikin bikos dem bon am into a tradishonal royal famili.
How im tek go skul
[chenj-am | chenj-am for orijin]Eze go St. Augustine Sekondiri Skul wey de Nkwere , Imo. Na 1970 im finish dis Sekondiri Skul. Leta, Eze go Califonia State Yunivasiti wey de Long Beach. Na dia im tek get e digree in Mekanika an Kemika Enjinerin. E go do Yunivasiti from 1974 go rish 1978.
How im tek wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]For 2023, Peaceland Yunivasiti wey de Enugu chuz Eze as dia pro-shasellor. Na Eze fond Atlas Oranto Petroleum in 1991