Aphrodite
Aphrodite na one big wuman god for old taim Greece wey bi say shi dey kontrol lov and biuti. Shi stil bi wuman god wey dey help pipul bon pikin. Aphrodite na one of di big 12 gods dem wey dem dey kol Olympians.
Among all di wuman gods, na shi fain pas, and shi sabi bihev pas. Dem mari ha to one god wey dem dey kol Hephaestus, wey na god of faya and iron wok. Bot Aphrodite no rili laik Hephaestus laik dat, so shi bigin dey waka waka wit oda gods and spirits. Di main pesin wey she dey folo na Ares, god wey dey kontrol war and fait.
For one old tori wey dem kol Iliad wey Homer rait, dem tok say Aphrodite na one of di wota spirit children (Oceanids). Bot for anoda tori wey Hesiod rait for Theogony, dem tok say Aphrodite kom out from sea foam. Di foam hapun bikos Kronos kot im papa Uranos blokos kom troway am for sea, and na dat place Aphrodite tek bon.
Dem get two islands wey pipul dey tok say na dia Aphrodite first land - Cythera and Cyprus. Pipul for dat taim dey du big festival for ha evri yia for di midul of drai season, dem dey kol di festival Aphrodisia.
Som smol smol wuman spirits wey dem dey kol Charites (na dem dey reprisent beauty and correctness) dey always folo Aphrodite waka, dey help am.
Aphrodite get some speshial animals and tins wey reprisent ha: dolphin, myrtle, rose, dove, sparrow, swan and pearl. Out of all dis animals, dove, sparrow and swan bi ha speshial animals.
For Roman pipul side, dem dey kol Aphrodite nem as Venus.
Aphrodite fine wel wel. Pipul dey always yuz ha bodi tek kompia eni wuman wey fine. Bot no bi onli fine shi fine, shi stil wise and sabi wel wel.
Pikin dem
[chenj-am | chenj-am for orijin]Aphrodite bon plenti pikin. Shi bon: Eros (god of lov), Phobos (god of fie), Deimos (god of panik), Harmonia (wuman god of peace), Pothos (spirit wey dey mek pesin dey want somtin), Anteros (spirit of lov wey pesin riton bak), Himeros (spirit of strong desire), Hermaphroditos (pikin wey kari man and wuman bodi togeda), Rhode (wuman god of Rhodes island), Eryx (faita wey sabi wrestle), Peitho (spirit of swit tok and persuasion), Tyche (wuman god of lok), Eunomia (spirit of gud law and order), Di Graces (grup of smol wuman god wey dey kontrol biuti and joy), Priapus (god of garden and plenti), and Aeneas (big hero wey leta bikom worio king). Aphrodite born total of 16 pikin dem.
Mariej mata
[chenj-am | chenj-am for orijin]Bikos Aphrodite fine pas all wuman for heaven, Zeus (di big god) fie say if dem liv ha fri, oda gods go bigin fait bikos of ha. So, Zeus kom giv Aphrodite to Hephaestus to mari.
Hephaestus hapi wel wel say e mari ha. E kom dey giv Aphrodite plenti fain fain gift, laik one speshial belt wey enitaim shi wie am, men go dey luv ha enihau.
Bot Aphrodite no tu laik Hephaestus laik dat. Shi kom dey spend most of ha taim wit Ares, god of war.
Shi stil spend taim wit Adonis and Anchises. Na so shi born plenti pikin dem.
Wit Ares, shi bon: Harmonia, Deimos (dey pronounce am as "day-mos"), Phobos, and Eros (dey pronounce am as "e-ros").
Wit Anchises (dey pronounce am as "an-chi-ses"), shi bon Aeneas (dey pronounce am as "ain-ne-us").