Anyanwu
Hau e go bi
Anyanwu (wey mins eyes of di sun in Igbo) na di goddess of sun" wey dey kontro good luck, mek pesin get nolej an sense. In tradishonal Igbo rilijion, dem dey kol am "Odinala". Anyanwu na Alusu wey mins a goddess wey dey protet pipo. Na Chukwu wey bi di homati kreate Anyanwu to do one mejo work. Di work wey Anyanwu dey do dey risembu di work wey simbi in Bakongo rilijion an some orishas in Yoruba rilijion.
Octavia E. Butler yuz di nem Anyanwu as one of di mejo karata wey dey im buk-dem Patternist Series". Sunny Nwazue yuz Anyanwu as di Spirit Face for im buk "Aktata Witch" an Nnedi Okorafor yuz Anyanwu inside im buk Akata Warrior".