Jump to content

Annie Okonkwo

From Wikipedia
Annie Okonkwo

Clement Annie Okonkwo (wey dem bon for 23 May 1960, and e kpai for 7 June 2023) na Naija politishan and big biznes pesin. Dem elekt am as Senate pesin for Anambra Central eria, and e bigin wok on 29 May 2007. E bi memba of People's Democratic Party (PDP).

Dem bon Okonkwo for 23 May 1960 for Ojoto, one town wey nia Onitsha for Anambra State. E get big skul satifiket for management from Harvard University for USA (1997–1998), big skul satifiket for commercial law and practice from University of Lagos (1995–1997), and big skul satifiket for marketing from University of Lagos (1994–1995). Wen e enta biznes, e build one grup of plenti kompani wey dey giv wok to pipul wey pas 7,000, and di kompani dem bi Reliance Telecomm, Clemco Industries, Modern Communications (satellite TV network), MacClemm Marketing Communications, Sunflower Nigeria, and Pentagon Oil.

Afta e join di Senate, dem put am for komiti wey dey luk oil wok, polis mata, envaroment (wia e bi vice-chairman), and farm wok. For one ripot wey check Senators wok for May 2009, ThisDay tok say e sopot law plan wey go help Fedral Govment mem impotant guds izi to get and chip for Naija pipul, and law plan to form Nigerians Citizens in Diaspora Commission. E try to bikom Anambra State Govnor for di February 2010 elekshon. But e no win, bikos di pesin wey dey di posishon bifor,Peter Obi, win again.

Okonkwo kpai for United States for 7 June 2023 wen e bi 63 yias old.

Wia dem gada di tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]