Anita Ukah
Man abi wuman | wuman ![]() |
---|---|
Kontri wey e kom from | Naija ![]() |
Fest nem | Anita ![]() |
Famili nem | Ukah ![]() |
Wen dem bon am | 1995 ![]() |
Ples wey dem bon am | Owerri ![]() |
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, Naijá langwej ![]() |
Wok wey e dey du | model ![]() |
Wie e go skul | Igbinedion University ![]() |
Eye kolor | black ![]() |
Hair kolor | black hair ![]() |
Anita Ukah (wey dem bon for 14 August 1995) na Naija wuman wey bi model an bizness wuman. Na Ukah kari fest posishon in di 2018 Edishon of MBGN (most bi-tiful gel in Naijiria). Ukah go repiset Naijiria in di 2018 Miss Wold Kompetishon wey hapun at Sanya Siti Arena in Sanya China. Dat Kompetishon hapun on 8 December 2018. For di 2018 Miss Wold Kompetishon, Ukah de inside di Top 30 gel wey fine pass for di Wold. Wen dem do Big Broda Naija Sisin 9 No Loose Guard, Ukah dey among di pipo wey enta final for di Rihaliti TV show.
How e tek stat life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Ukah kom from Imo Stet. Ukah peret bon Seven pikin-dem
How e tek go skul
[chenj-am | chenj-am for orijin]Ukah finish Igbinedion Yunivasiti, Okada in 2016. Ukah na Medically Laboratory Sayentis. E get Masta Digree in Poblik Health from Yunivasiti of Chester.
How e tek do fashon pared
[chenj-am | chenj-am for orijin]Ukah fest stat fashon pared in 2014 wen e still dey Igbinedion Yunivasiti wey de Okada. For di Yunivasiti, Ukah enta di Miss Igbinedion Kompetishon an e win di Kompetishon. Imo Stet pipo pik Ukah as pesin wey go repiset dem in 2018 MBGN and im kari fest for di kompetishon. Na for Okara Kolsho Sentra wey de Yenagoa, Bayelsa Stet dem do di kompetishon.
Pipo sabi Ukah as pesin wey like to dey yuz wetin dem mek in Naija. For 2019, Ukah start e own Fashon Bizness an im nem am The Uzo Brand. For im fashon Bizness, na bag e dey sell pass.