Jump to content

Amina Lawal

From Wikipedia

Amina Lawal Kurami na one Nigerian wuman wey dem bon for 1972. For 2002, one Sharia court for Funtua, wey dey insaide Katsina State for northern Nigeria, tok sey mek dem stone am til shi die bikos shi du shi du woman and man mata wit pesin wey no bi ha hosband an shi kari belle for am.


Di man wey shi tok sey na im giv am belle, Yahayya Muhammad Kurami, dem free am bikos im swear for Qur’an say e no do di thing. But for Maliki school of thought for Islam, di pikin wey Amina bon na evidence sey shi du di tin, so shi no fit uze am swear wey di man use take free herself.

Di wahala wey folo

[chenj-am | chenj-am for orijin]

As dem sentens Amina to death by stoning, di mata vex plenti pipu for di wod. Meni pipu tok sey e no folo for koret Islamic law, an leta dem Kansu di judgement. Afta di wahala, Amina Kon leta marry again.

Wetin hapun bifor

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Amina Lawal na di sekond wuman wey dem wan stone for Nigeria bikos shi do wuman an man mata bifor marrej. Di first wuman, Safiya Hussaini, get di sem wahala, but for March 2002, di court kansu ha judgement.

For year 2000, Zamfara Stet wey dey for northern Nigeria introdus Sharia lor, an di lor don spread rish at least twelve oda stet wey plenti Muslims dey.

Appeal wey sav Amina

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Pipu wey dey faight for human rights hep Amina kari di matter go court again. On 25 September 2003, five judges for Katsina State Sharia Court of Appeal luk di case, an four of dem tok sey di judgement no folo Islamic lor bikos:

1. Dem no giv Amina beta lorya to defend herself.


2. Say shi get belle no be beta evidence.


3. Ha confession no dey valid.


4. Na onli one judge dey kourt wen dem first sentence her, but di law tok sey na three judges suppose dey.


One Nigeria NGO wey dem kol Baobab for Women's Human Rights an som loryas wey sabi both normal lor and Sharia lor hep Amina. One of di loryas, Hauwa Ibrahim, na strong human rights lawyer wey dey hep pipu wey dem wan punish onda Sharia law.

Dem uze one Islamic argument wey tok sey sumetaimes, pikin fit stay for wuman belle for up toe five years bifor e go bon (di law kol am "extended pregnancy"). Dem talk say two years bifor shi bon di pikin, Amina stil bi married woman, so di case no suppose hapun.

How pipu tek reakt

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dis mata cause big kasala for Christians an Muslims for Nigeria. Meni pipu for Western kontries vex wel wel. Som wuman wey wan do Miss Wod beauty contest for 2002 tok sey dem no go kom Nigeria bikos of di case. Di wuman wey be Miss Norway tok sey di judgement dey “disgusting.” Miss Ivory Coast and Miss Togo too tok sey dem no go kom.

Oprah Winfrey Show du special program abaut Amina Lawal case an tel pipu mek dem send email to Nigerian Ambassador for U.S. Over 1.2 million emails land bikos of di show.

Amnesty International, one big human rights grup, tok sey Nigeria no supos allow dis kaind punishment bikos dem don sign one international human rights lor wey no allow torture or wicked treatment.

Even former U.S. President Bill Clinton tok sey mek dem pardon Amina. But di wahala bi sey Nigeria get difren lars for Muslim and Christian arias, an President Obasanjo wey be Christian fom southern Nigeria no get pawa to chenj Sharia judgement.

Di petition wey pipu sign

[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 2002, one petition wey dem kol "Save Amina" get plenti signatures. But by 2003, som human rights grups for Nigeria tok sey di petition get som wrong information, an e dey do as if na only foreign pipu sabi wetin gud pas.

For May 2003, Nigeria Embassy for Netherlands tok sey no Sharia court don order mek dem stone Amina, say di reports na fake niuz wey wan spoil Nigeria name. But di Nigerian Ambassador for U.S., A.A. Agada, leta tok sey Amina get right to fair hearing, an di case neva finish for court.

Amina Lawal for pop kolsho

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di mata even enta buk an TV. One Canadian raita, Will Ferguson, rait one novel wey di main character, Amina, bi yung pregnant wuman wey dey run komot fom northern Nigeria.

One American philosopher, Alison M. Jaggar, rait one article for 2005 abaut Amina case, wey she title "Saving Amina."

Wia dem gada tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]