Jump to content

Amala (food)

From Wikipedia
Amala with ewedu

Àmàlà na one popular swallow (okèlè) food wey start from the Yoruba people for southwestern Nigeria and other part of Yorubaland. [1]Dem dey make am from yam, cassava flour, or flour from unripe plantain.[2]

To prepare am, dem go peel the yam tubers, slice am, wash am well, dry am, then grind am turn to flour. Dem dey also call this flour èlùbọ́.

Normally, yam dey white, but when dem dry am before grinding, e dey turn brown, and na wetin give àmàlà im brown colour.

Àmàlà na popular food wey people dey chop with ewédú soup and gbẹ̀gìrì (black-eyed beans soup). But people still dey serve am with other kinds of soup (ọbè) like ẹ̀fọ́, ilá (okra soup), and ogbono soup

na three types of àmàlà dey: àmàlà isu,[3] àmàlà láfún, and amala ògèdè.[4]

Àmàlà isu, wey be the most common type of àmàlà, na yam-based. The yam species wey dey best for making àmàlà na Dioscorea cayenensis (Ikoro) because e get plenty starch.

Because yam dey spoil quickly, people dey often dry am and turn am into flour. Àmàlà isu dey made from dried yam, and na wetin dey give am black or brownish colour when e enter boiling water.

Àmàlà get plenty carbohydrate, and e important as carbohydrate source, especially for yam-growing areas of West Africa.[5]

Cassava flour (àmàlà láfún)

[chenj-am | chenj-am for orijin]

dem make Àmàlà láfún from cassava flour. Dem dey also call Dried cassava flour , lafun.[6]

Plantain flour (amala ogede)

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Àmàlà elubo ogede na another type of àmàlà wey get lighter colour. The flour from plantain get low carbohydrate, wey make am suitable for diabetics.

To make am, unripe plantain dey peeled, dried, and grated into boiling water, wey form light brown paste when e don cook.[7][8]

  1. Roots, Tubers, Plantains and Bananas in Human Nutrition. Rome: Food and Agriculture Organization of the United Nations. 1990. p. 68. ISBN 978-92-5-102862-9.
  2. https://books.google.com/books?id=bIsz-PA75b4C&pg=PA172
  3. "How Elubo is Made – Yam Flour (Amala-Isu) – Abebi Foods" (in Amẹ́ríka Ínglish). Retrieved 2022-12-12.
  4. "Amala Food Recipe | How to Cook Amala - African Food Network" (in Amẹ́ríka Ínglish). 2017-04-09. Retrieved 2022-05-10.
  5. https://scholar.google.com/scholar_lookup?journal=Trop.+Sci.&title=Physical,+chemical+and+sensory+evaluation+of+dried+yam+(Dioscorea+rotundata)+tubers,+flour+and+amala+%E2%80%93+a+flour%E2%80%90derived+product&volume=41&publication_year=2003&pages=151-156&#d=gs_qabs&u=%23p%3D36FZS9PuO20J
  6. "How To Make White Amala – Lafun – The online cook" (in Brítísh Ínglish). Archived from the original on 2025-12-16. Retrieved 2026-01-21.
  7. "Plantain Fufu (Amala Ogede) Recipe :: Nigerian Dishes :: Galleria Health and Lifestyle, Nigeria". www.nigeriagalleria.com. Retrieved 2022-05-10.
  8. Sue (2015-08-02). "How to Make Plantain Flour". Backcountry Paleo (in Amẹ́ríka Ínglish). Retrieved 2022-05-10.