Amaka Igwe
Man abi wuman | wuman ![]() |
---|---|
Kontri wey e kom from | Naija ![]() |
Nem for lokal langwej | Amaka Igwe ![]() |
Orijina nem | Amaka Igwe ![]() |
Wen dem bon am | 2 January 1963 ![]() |
Ples wey dem bon am | Port Harcourt ![]() |
Wen e kpai | 28 April 2014 ![]() |
Place of death | Enugu ![]() |
Cause of death | asthma ![]() |
Fest langwej | Igbo langwej ![]() |
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, Igbo langwej, Naijá langwej ![]() |
Wok wey e dey du | film producer, film director, raita ![]() |
Wie e go skul | Obafemi Awolowo University, University of Ibadan ![]() |
Rilijon | Christianity ![]() |
Eye kolor | brown ![]() |
Hair kolor | black hair ![]() |
Personal pronoun | L484 ![]() |
Amaka Igwe (2 January 1963 – 28 April 2014) na Naija pesin wey dey mek fim an wey sabi wok for redio an televishon. Na shi get Top Radio 90.9 Lagos an Amaka Igwe Studios. Na shi bi one of di pipu wey stat di sekond generation of Nigerian fim, wey hep push di video fim industry wey we dey kol Nollywood today. Shi bi strong pesin for di industry until shi die for 2014 bikos of asthma attack.
For 2 January 2020, Google celebrate ha 57th posthumous birthday with Google Doodle.
How shi stat life an edukeshon
[chenj-am | chenj-am for orijin]Uzoamaka Audrey "Amaka" Igwe na Isaac an Patience Ene bon am for 2 January 1963 for Port Harcourt, di capital of Rivers State wey dey south-south Nigeria. She bi di number five pikin insaid seven children, an di nomba four among six sistas. Her papa dey kol am "GCO" (General Commanding Officer) an ha mama dey kol am "Storm" bikos shi no dey eva gree stay one plez—shi holways get one thing wey she dey du. Wen shi dey smol, shi dey akt lik Minister of Youth, Sports an Culture.
Shi go All Saints School and Awkunanaw Girls High School for Enugu State. She sabi plenti sport—shi sabi box, she pley basketball, an shi even be di captain of di girls' football team. When shi dey do her A-Level for Idia College, Benin, shi stat dey sho di creative saide wey shi get. Shi tich pipu how to dans Atilogwu an shi even compete for national level. Shi also stat to dey rait pley an songs.
Amaka bin wan stodi lor, but JAMB give her "Education and Religious Studies (Theology)" instead. So, shi go University of Ife (now Obafemi Awolowo University, OAU) go stodi di course. Afta she finish for OAU, shi join MNET short film Barber's Wisdom as di director. Later, shi go University of Ibadan go do her master’s digre for Library and Information Sciences.
Wen shi dey do NYSC, she work as travelling secretary for Scripture Union. Shi leta wok for Anambra State University of Technology as executiv dairektor for Eida Information Systems bifor shi enter di creative industry. Shi mari Charles Igwe for April 1993, an dem bon three pikin.
Talent
[chenj-am | chenj-am for orijin]Amaka Igwe sabi meni thins—shi bi raita, produsa, daireckto, buzneswuman, an ticha. Shi bi one of di pipu wey hep modern Nigerian TV drama and fim stan wel. Sh blo for di whole country wen shi rait an produs di popular TV soap Checkmate an di comedy series Fuji House of Commotion. Shi stil du big Nollywood fims lik Rattle Snake an Violated, wey mek ha kompini Amaka Igwe Studios stan out for di video film era of Nollywood.
She be di person wey start BOBTV Expo, and she still be di owner of Top Radio 90.9FM for Lagos, Amaka Igwe Studios, Q Entertainment Networks, and one DSTV channel.
How dem tek rememba am
[chenj-am | chenj-am for orijin]People go always remember Amaka Igwe because she change di way people dey see Nigerian movie and TV production. She no gree do anyhow work just to make money—she dey always chase high standard, even when Nollywood never get respect. She inspire plenty filmmakers for Nigeria and di whole world.
Amaka bi person wey get strong belief for God, shi lov ha family wel-wel, an shi dey holways put excellence for everytin wey shi do. Shi believe sey quality wok dey very important, an shi dey holways hep pipu gro. Shi tel pipu wey shi train sey shi go giv dem everytin wey shi sabi, mek dem tek add join dia own knowledge so dem fit even beta pas ha.
Honors an Tribute
[chenj-am | chenj-am for orijin]Amaka Igwe win plenti awods for di wok wey shi do. For 2011, Nigeria honor ha wit Member of the Federal Republic (MFR) awod bikos of di big wok wey shi du for di creative industry.
For 2 January 2020, Google celebrate her 57th birthday with Google Doodle.
Death
[chenj-am | chenj-am for orijin]Amaka Igwe die for Enugu on 27 April 2014 by 8:30 pm afta dem trai sav her fom serious asthma attack. Plenti big pipu, including Rochas Okorocha wey be di governor of Imo State dat time, an Nollywood pipu go ha burial.
Som tins wey shi tok bifor shi die
[chenj-am | chenj-am for orijin]"I be filmmaker wey no dey hide say I wan make money. I dey make film to make money."
"I go give you everything wey I get, make you take join your own, so you go even better pass me."
."By di special grace of God."
."Mr. President, wetin be Arik Air without airport?"
."Nollywood na global movement."
.Filmography (Movies Wey She Do)
.Rattle Snake 1, 2 & 3 (1995)
.Violated 1 & 2 (1996)
.Forever (1997)
.To Live Again
.Full Circle
.A Barber's Wisdom (2001)
.TV Series
.Fuji House of Commotion
.Solitaire
.Now We Are Married
.Infinity Hospital
.Bless This House
.Checkmate