Alex Ekubo
| Man abi wuman | man |
|---|---|
| Kontri wey e kom from | Naija |
| Nem for lokal langwej | Alexx Ekubo |
| Fest nem | Alexis |
| Famili nem | Ekubo |
| Wen dem bon am | 10 April 1986 |
| Ples wey dem bon am | Arochukwu |
| Wen e kpai | 11 May 2026 |
| Place of death | Lagos |
| Manner of death | natural causes |
| Cause of death | kidney cancer |
| Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, Naijá langwej |
| Wok wey e dey du | actor, model |
| Pat of wok wey e put mind | actor |
| Wie e go skul | University of Calabar |
| Hair kolor | black hair |
| Eye kolor | brown |
Alex Ekubo Okwaraeke (dey bon am 10 April 1986 an e kpai for 11 May 2026) na Naija aktor, entatena, an pesin wey sabi elp pipul wel wel. Na wen Elubo kari sekod for Mr Nigeria kompetishon in 2010 pipul kom stat to dey no am an e leta de insaid one fim kol Weekend Getaway. For 2020, Elubo nem de insaid di list of Afrika pipul wey neva rish 40 wey get levuls for di tins wey e don du for entatemet an sosha divelopmet for Afrika.
Hau im tek stat laif an go skul
[chenj-am | chenj-am for orijin]Na for Arochukwu wey de Abia Stet na im Alex Ekubo-Okwaraeke kom fom. E go Fediral Govmet Kolej wey de Daura for Kaduna Stet an e rid Lo for Yunivasiti of Kalaba. For 2021, For 2021, Institut Supporter de Communication et de Gestion (ISCG Yunivasiti) wey de Kotonou, for Benin, giv Ekubo onori digri in Art an Kolsho
Hau im tek wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]Ekubo fest stat to dey akt for fim smol smol wey e sho for Sinners in the House fim (2003) wey Lancelpt Oduwa Imaseun mek. Leta, e kom akt insaid Afamefuna: An Nwa Boi Story, Power 1, A Sunday Affair, Omo Ghetto: The Saga, The Bling Lagosians, Catch.er, Zero Hour, The First lady, Lagos Cougar, an Weekend Getaway. Insaid plenti of dis fim-dem, Ekubo dey akt as fain boi or as pesin wey dey mek pipul laff. Di kain tin wey e dey du for fim as e dey sho sey e fonn, dey put emoshon for fim mek pipul dey praiz am wel wel. Ekubo don akt insaid Nollywood fim-dem wey don pass 100 an e don wok wit plenti Nollywood fim-meka.
Hau im tell elp pipul
[chenj-am | chenj-am for orijin]A-pat for di entatemet fim indostri wey e dey akt insaid, Pipul sabi Ekubo wel wel as pesin wey dey elp pipul an wey laik to sopot yong yong pipul. E dey join for kampain wey konsain hau to elp pipul wey dey hapun for Naija an West Afrika. For 2020, Sapio Klub SDG ( Sustainable Goals Development) giv am satifiket of excellence for di tin wey e don du to sopot entatemet an hau e tek elp pipul for Afrika. For 2021, Nigerian Nashonal Awod giv as di Global Sosha Givin Aktor of di yie. For 2023, Ekubo kolet di Rotary Youth Ambasedor of di Yie onda Rotary Intanashonal District 9142
Im pasona laif
[chenj-am | chenj-am for orijin]Pipul sabi Ekubo as pesin wey sabi diress wel wel as e nem dey ol-weis de di list of pipul wey sabi diress akros Afrika. Ekubo laik to de lo-ki an laik to yuz im sosha midia to elp yong pipul an tok wey dey go on for sosa-e-ti.
Hau im tek kpai
[chenj-am | chenj-am for orijin]Na kidni kansa kpai Ekubo . E kpai on 11 May 2026 for one hospitu wey de Legos Stet wen e bi 40 yies old.