Alaba Lawson

Chief Alaba Oluwaseun Lawson (18 January 1951 – 28 October 2023) na Naija biznes pesin an akademik.
Shi bi di first wuman wey bi president of NACCIMA an chairman for di board of di Governing Council, Moshood Abiola Polytechnic, Ogun State.
Chief Lawson sef na di president pro-tempore for di Forum of Female Traditional Rulers for Nigeria.
Hau shi stat life an edukeshon
[chenj-am | chenj-am for orijin]Chief Lawson kom fom Jiboku-Taiwo famili for Abeokuta, wey bi di capital of Ogun State. Shi du ha primari an secondari school for St. James’ African Primary School, Idi-Ape, Abeokuta (1957–1962) an Abeokuta Girls Grammar School, Abeokuta, wey shi finish for 1968.[1] before she proceeded to St. Nicholas Montessori Teachers’ Training College at Prince's Gate, England in 1973 where she obtained a 1st Class Diploma in Education.[2].
Life an work
[chenj-am | chenj-am for orijin]Lawson stat ha tiching wok in 1969 for Children House School, Ibara. Wen shi dey England, shi tich for Queen's Gate Montessori Nursery School an Mill Hill Nursery an Junior School. For 1977, shi kom bak to Nigeria kom opun ha own school wey shi kol Lawson's Childcare Nursery and Primary School. Shi stat wit onli three pikin, but di school don grow rich Lawson Group of Schools.
Apat fom school, she stil open one trading an distribution kompini wey dem kol Capricorn Stores Ltd. From 1968 go rich 1996, shi dey share product for big companies lik:
.Nigerian Breweries Ltd
.Nigerian Bottling Company Ltd
.Guinness Nigeria Ltd
.West African Portland Cement Ltd
For 1995, na shi bi President for Abeokuta Chambers of Commerce. For year 2000, shi stil bi di President for Ogun Council of Chambers of Commerce, wey shi lead til 2002.
For 2009, shi opun one Microfinance Bank wey dem kol Abestone Microfinance Bank to help small-small biznes dem (SMEs).
On 25 May 2017, Chief Alaba mek histri as di first wuman wey dem elect as Presido for National Association Of Chambers of Commerce, Industry, Mines And Agriculture (NACCIMA) afta Dr. Benny Edem finish him tenure.
Chief Alaba Lawson kpai on 28 October 2023, wen shi bi 72 years old.
Chieftaincy Titles
[chenj-am | chenj-am for orijin].Otun of Oko
.Asiwaju Iyalode of Egbaland
.Otun Iyalode of di Egba Christians
.Iyalode of Egbaland (dem later remove her from dis position)
.Iyalode of Yorubaland
Wia dem gada tori
[chenj-am | chenj-am for orijin]- ↑ Admin. "NACCIMA gets first female national president". Vanguard. Retrieved 22 July 2017.
- ↑ Admin. "The Chairman – Iyalode Alaba Lawson MFR – Justice of Peace". mapoly. Archived from the original on 22 July 2017. Retrieved 22 July 2017.