Ala (Odinala)
Ala (wey pipo stil sabi as Ani, "'Ana"', "'Ale"', an "'Ali"' inside difren Igbo langwej) na di fimeli god of di earth. Ala na stil di goddess wey dey kontro how pipo dey bihaf norma, weyda wuman go get belle or e no go get, an weyda pipo go sabi somtin or not. In Odinani, na Ala dey kontro di land of di dead an na im dey kari di belle of our four-four fada-dem. Ala for Igbo langwej mins "Earth" an dis one mins sey dis goddess get pawa ova di Earth an di graund. For all di gods wey Igbo pipo dey woship, na Ala dey respet pass. Amadioha bi di hosband of Ala. Amadiola bi di god wey dey kontro hevun.
Sins Ala bi di goddess wey dey kontro how pipo sopoz bihaf, e dey always joj mata of human bein. Na Ala dey kontro Igbo law an dia kostom. Di nem of Igbo law an kostom na "Omenala". Wetin no norma (taboo) or wey bad if pesin do am in Igbo law na nso Ala. Evri graund for Igboland na holi land bikos na Ala bi di graund.
Weyda land go produs food dipend on Ala. Ala di yuz python (Igbo: eke) as im meseja. Wen pipo wan to draw di pikshon of Ala, dem dey draw am as a kween wey sit down for throne an im famili araund am. For hodin days, na mud dem dey yuz mek di emeji of Ala. Di size of di emeji go jus risembu di size of norma human bein. Dis emeji dey de inside di shrine an Igbo pipo dey kol am mbari.
Im pawa
[chenj-am | chenj-am for orijin]Dem dey tok sey wen pesin komit wetin oyinbo dey kol taboo in di komuniti, di pesin don in-salt Ala bi dat. ( For Igbo langwej, dis tin is kol ajo njo or Aru Ala or Alu Ani). Di risin bi sey na on top di earth di pesin do am an na Ala bi di kontrola of di Earth.
Ala stil bi di goddess wey dey kontro how to tins go de for Igbo sosa-e-ti. Na Ala stil bi do goddess wey dey protet wuman an smol smol pikin-dem. Meni times, pipo dey draw pikshon of Ala wey karo smol pikin for hand. Di simbo of Ala na full moon. Pipo bilif sey wen pipo kpai, dia spirit dey stay inside di belle of Ala. Di hol komuniti nid to respet Ala bikos evri bodi dey live an waka inside di earth. For somtimes, pipo bilif sey Ala fit opun graund an pipo go enta graund an kpai. Wen Igbo pipo wan di yam festiva, dem dey always dey give honor to Ala.