Jump to content

Akor Adams

From Wikipedia

Akor Jerome Adams (wey dem born for 29 January 2000) na Naija profeshonal futbola. E dey play as strika for Sevilla, one big klub for Spain La Liga, an for Nigeria nashonal team (Super Eagles).

For August 2018, Akor Adams join one Norway klub wey dem dey kol Sogndal, fom Jamba Football Academy for Nigeria.

E play im first match for di klub on 28 August 2018.

For 2020 season, injury wori am wel-wel, so e no fit play plenti matches. Im agreement wey dey wit playas and club finish for end of 2021 season. Bifor e komot, e skore 10 goals for 28 matches wey e play.

On 2 December 2021, Akor sign three-year contract wit Lillestrøm.

E fest play competitive match for cup competishon, and e skore goal against Nardo. Afta dat one, e play im first league match (Eliteserien) on 2 April 2022 against HamKam, and e skore one goal for match wey end 2–2 draw.

Anoda one, Akor Adams skore 28 goals for 50 matches for Lillestrøm, for ol competitions.

On 7 August 2023, Akor join Montpellier, one France Ligue 1 club, for about €4 million.

Fom August 2023 to January 2025, e skore 11 goals for ol competishons wey e play for Montpellier.

On 27 January 2025, Akor Adams muv go Sevilla for Spain La Liga, for about €5 million transfer fee.

E sign four-and-a-half-year kotract.

Im first goal for Sevilla na on 28 September 2025, for away match against Rayo Vallecano. Na im late goal win the match 1–0.

week wey folo, e skore against Barcelona, na im team fourth goal for match wey Sevilla win 4–1. Up till nau, im total wok for Sevilla be 3 goals and 2 assists.

Akor Adams play for Nigeria Under-20 team for 2019 FIFA U-20 World Cup. Nigeria komot for last 16 stej, afta dem luz 2–1 to Senegal.

On 4 October 2025, dem kol am for senior Nigerian team (Super Eagles) for di first time, for 2026 World Cup qualifiers against Lesotho and Benin.

For im first match as substitute, e skore goal against Lesotho.

Rekord of ol matches e don pley

[chenj-am | chenj-am for orijin]
Appearances and goals by club, season and competition
Club Season League National cup Europe Other Total
DivisionAppsGoalsAppsGoalsAppsGoalsAppsGoalsAppsGoals
Sogndal 2018 Norwegian First Division 1010010111
2019 1230010133
2020 202242
2021 261010102810
Total 501410525616
Lillestrøm 2022 Eliteserien 23852102910
2023 151553002018
Total 3823105104928
Montpellier 2023–24 Ligue 1 328123310
2024–25 15310163
Total 4711224913
Sevilla 2024–25 La Liga 4040
2025–26 14310153
Total 18310193
Career total 15351147105217460

Templet:Updated

Appearances and goals by national team and year
National teamYearAppsGoals
Nigeria 202572
202642
Total114
Scores and results list Nigeria's goal tally first, score column indicates score after each Adams goal.

Wia dem gada tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]