Jump to content

Akachi Adimora-Ezeigbo

From Wikipedia

Akachi Adimora-Ezeigbo na Naija wuman wey sabi rait buk and tich pipul. Shi don rait plenti tins laik tori-buk, poem, shot shot tori, children buk, essay and newspaper atikul.[1] Shi don win plenti awod for Naija, ivun Nigeria Prize for Literature join.[2]

Tori abaut ha laif

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Eastern Naija dem bon Akachi Adimora-Ezeigbo and na for dia shi grow. Bot nau shi dey liv for Lagos. Shi bi di fest pikin of Joshua and Christiana Adimora. Shi get five brodas and sistas. Shi grow for vilej side smol, grow for town side tu smol. Na wai wen shi dey rait ha tori-buk, shi dey put vilej and town join for ha tori.

As e bi say dem bon ha for East, she don liv for meni places for Naija – East, North and West. Shi don travul go plenti places for Africa, Europe and America.

Shi go University of Lagos wie shi get ha Bachelor of Arts (BA) and Masters (MA) for English. Leta shi go University of Ibadan wie shi get ha Doctor degree (Ph.D.) for English tu. Shi stil get anoda certificate for Education (PGDE) from University of Lagos.

Shi sabi du plenti tins: shi bi ticha, raita, tori-buk meka, pesin wey dey koret oda pipul wok, essay raita, jonalist, and skul woka. For 1999, dem mek ha professor for University of Lagos. Shi don dey tich for dat yunivasiti from 1981. Shi ivun bi head of English Department for 1997, 1998, 2002 to 2005, and 2008 to 2009.

For September 2015, shi waka go Federal University Ndufu-Alike, Ikwo for Ebonyi State, South-East Naija. Dia shi stil dey tich and help yong lecturers.

Shi mari Professor Chris Ezeigbo, and dem get three children.

Wok wey shi don du

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Bifor shi stat to dey tich for yunivasiti, shi fest tich for sekondri skul and tichas kolej. Shi wok wit two newspapers for Lagos – The Independent (1992–1995) and The Post Express (1997–1999).

As shi dey wok for newspaper, shi dey write big big atikul, tori abaut difrent mata, and shi get ha own regula column.

For University of Lagos, shi don du meni big wok. Shi bi sub-dean (smol oga for Faculty of Arts) from 1992 to 1994. Shi stil bi acting head for English Department for 1997/1998.

For hostel side, shi help manej students for Moremi Hall and Moremi Annexe from 1981 to 1984 as assistant hall warden. Leta shi kom bi hall mistress for Madam Tinubu Hall from 1994 to 1996, and for Amina Hall from 1996 to 1997.

Shi stil join meni raitas grup. From 1995 to 1997, shi bi national treasurer for Association of Nigerian Authors. Shi bi vice president for Women Writers of Nigeria (WRITA) from 1998 to 2000. Nau, shi bi first vice-president of P.E.N. Nigeria and financial secretary for WRITA National.

Wie dem gada di tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  1. Geoffrey Kwadwo Gyasi, "Interview with Nigerian Writer, Akachi Adimora-Ezeigbo", Munyori Literary Journal, via Geosi Reads, 22 August 2013.
  2. "Akachi Adimora-Ezeigbo", African Books Collective.