Aisha Salaudeen
Aisha Salaudeen (wey dem bon for 26 September 1994) na Nigerian journalist wey sabi plenti tins, shi bi feminist, produsa, an raita. Right now, she dey wok for CNN. For November 2020, dem giv ha Future Awards Africa Prize for Journalism bikos of di kain tori wey shi dey kova for Afrika. Shi stil bi guest speaker for Ake Arts and Book Festival 2020.
How she tek stat journalism wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]Salaudeen stat ha media wok for 2013 wen shi volunteer as presenta for University of Bradford redio station. Wen she kom bak Naija for 2017, shi komot fom her accounting wok go follow journalism full-time.
Shi first do freelance wok for Al Jazeera an Financial Times, bifor shi join Stears Business as journalist for 2018.
Wok for stears biznes (2018–2019)
[chenj-am | chenj-am for orijin]For Stears Business, shi rait abaut biznes an kolsho. For July 2018, shi rait one investigation report wey shi kol Earthquakes, lung disease, an dirt: what it feels lik living in Kurata. The report tok abaut one community wey dey sofa heavi environmental wahala.
For February 2019, shi rait anoda report wey shi kol Single women cannot rent property in Nigeria, wey sho how e hard for single women for Naija to rent house on dia own.
For April 2019, she komot for Stears go join CNN.
Wok for CNN (2019–now)
[chenj-am | chenj-am for orijin]Now, Aisha Salaudeen bj digital features produsa for CNN. The first tori wey shi rait for CNN na abaut one 9-year-old boy wey don create more than 30 video games. Sins dat taime, she don produce tori wey touch issues lik women trauma, inequality, abortion rights, an sexual violence.
Big wok wey shi don do
[chenj-am | chenj-am for orijin].Single women cannot rent property in Nigeria (2019) – for Stears Nigeria.
.This 9-year-old has built more than 30 mobile games (2019) – for CNN.
.The woman risking her life to photograph the forgotten victims of war (2019) – for CNN.
Internashonal Recognition
[chenj-am | chenj-am for orijin].For 2019, dem put Salaudeen nem for YNaija New Establishment List.
.For August 2020, British Vogue put ha nem insaide list of 50 Trailblazing Creatives an Young Activists fom Across.
For December 2020, shi win The Future Awards Africa prize for journalism.
Awods
[chenj-am | chenj-am for orijin]| Year | Award | Category | Result | Recipient |
|---|---|---|---|---|
| 2020 | The Future Awards Africa | Journalism | Won | Herself |