Ahmad Gumi
| Man abi wuman | man |
|---|---|
| Kontri wey e kom from | Naija |
| Wen dem bon am | 1959, 7 November 1959 |
| Ples wey dem bon am | Kaduna |
| Papa | Abubakar Gumi |
| Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, Arabic, Naijá langwej |
| Wok wey e dey du | mufti, cleric |
| E pipul | Fulbe people |
| Rilijon | Sunni Islam |
| Madhhab | Malikism |
Ahmad Abubakar Gumi na Naija pesin wey bi muslim prisha, pesin wey go skul wel wel, an forma Harmi Ofisa wey rish di posishon of Kaptain wen e de Naija Harmi. Na Ahmad bi dia Mufti an Mufassir for Kaduna Sentra Mosque Sultan Bello.
How im tek start life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Ahmad Gumi na di hodest pikin wey Shaykh Abubkar Gumi bon. Na for Kano dey bon Ahmad Gumi. E four-four fada dem sabi Islamik stodi wel wel an Ahmad Gumi papa bi di fest Grand Khadi of di old Norta Rijion. Ahmad papa rili do e best to mek Islam no kpai for Norta Naija wen Sir Ahmdu Bello still de alive.
How im tek go skul
[chenj-am | chenj-am for orijin]Ahmad Gumi go Sardauna Memorial College (SMC) for im sekondiri skul edukeshon. Wen Ahmad Gumi finish sekondiri skul, e enta Ahmadu Bello Yunivasiti. Ahmad Gumi leta join di Naija Harmi wen e enta Nigeria Difends Akademi. Wen Ahmad Gumi don bi kaptain for Naija Harmi, e risain an go Umma al-Qura in Saudi Arabia to kontiniu im Islamik edukeshon. For di Yunivasiti, e rid Islamic Jurisprudence an Tafsir. Ahmad Gumi klass mate na Abdur-Rahman Ass-Sudais, Saud Al-Shuraim. Na Ahmad Gumi dey give di evri-year Ramadan Tafseer in Sultan Bello Mosque wey de Unguwan sarki Kaduna.
E wok for Naija Harmi
[chenj-am | chenj-am for orijin]Ahmad Gumi sarf in di Nigeri Harmi Medika Corp (NAMC) as a medika Ofisa an im ritaya as a kaptein.
Wen Ahmad Gumi no about di Greenfield Yunivasiti studet wey dem kid-nap, e tok to di kid-napa an 27 studet kom out bikos of wetin Ahmad Gumi do.
E wok as a piss-meka
[chenj-am | chenj-am for orijin]Bikos of di wahala wey de hapun for ova Naija, Ahmad Gumi hagri to helep di fediral govamet to tok to pipo wey dey do kid-napin to stop dia bad karata an mek wahala no dey Naija Ahmad Gumi no dey fear as e dey enta forest go mit dis kid-napas dem dey go find dem as e dey prish for dem to stop wetin dem dey do. Ahmad Gumi go tel dem sey mek dem ripet an sey Allah go forgive dem
Palava
[chenj-am | chenj-am for orijin]On Friday 25 June 2021, di Dipatmet of Siki-o-riti Sarvis (DSS) kol Ahmad Gumi kom dia ofis sey mek e kom tok wetin im no about terrorist.