Ahia Njoku
Ahia Njoku wey pipo also sabi as Ifejioku, Aha Njoku na one wuman-god (goddess) wey di pipo of Igbo land bilif sey na im dey mek yam gro for dia farm. Igbo pipo na one tribe wey de easta part of Naija Na Ahia Njoku dey kontro how di yam go tek plenti for farm. In Igbo land, yam na one of di impotat fud wey di komuniti dey chop wel wel. Igbo men no dey yuz di plantin of yam play at all at all. One night wen di moon dey shine wel wel bifor di Niu Yam Festiva go start, di Igbo pipo dey yuz dat night praize an woship Ahia Njoku. Di nem of dis festiva na: Ahanjoku Festiva. Pikin-dem wey dem don chuz sey na Ahia Njoku go bi dia god wey dem go dey woship dey get one nem wey bi Njoku. Di bilif bi sey, dos pikin-dem go bikom a beta yam farma wen dey grow up. Dis one, go mek dem popula wel wel. Dis nem, Njoku go mek di pesin wey de ansa am dey feel like sey somtin or sombodi wey pawaful dey sopot am. Di menin of di nem na Larger than life.