Jump to content

Agriculture

From Wikipedia

Agriculture na di work wey involve to dey prepare land, plant crops, tek care of dem, harvest dem, plus rear animals too. E still inklud forestry (taking care of tris) and aquaculture (fish farming). Agriculture na one big rison why human civilization tek grow, because when pipu begin farm plants and animals, fud come plenty, and that one make dem fit settle for cities.[1][2]

Long time ago, humans don dey gather grains like 105,000 years ago, but dem start to plant am properly around 11,500 years ago. Animals like sheep, goat, pig, and cow dem don domesticate like 10,000 years ago. Different places for the world start to grow plants on their own. As time go, especially for 20th century, big-big farming (industrial agriculture) wey dey focus on one type of crop (monoculture) come take over.

Where Dem Gada Di Tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  1. https://www.fao.org/4/x6941e/x6941e04.htm
  2. https://www.eionet.europa.eu/gemet/en/group/234