Adewale Wahab

From Wikipedia
Adewale Wahab
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Country for sportNaija Chenj-am
Fest nemAdewale Chenj-am
Wen dem bon am4 October 1984 Chenj-am
Ples wey dem bon amPort Harcourt Chenj-am
Fest langwejYoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey duassociation football player Chenj-am
Position played on team / specialitymidfielder Chenj-am
Sportassociation football Chenj-am

Adewale Dauda Wahab (dem bon am for October 4, 1984) na Naija futbola wey dey plai midfield posishion. Im bin dey plai for AC Bellinzona til di end of 2010-2011.

Tori of e futbol karia[chenj-am | chenj-am for orijin]

Roma[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wahab stat to plai bol for ovasee for Italy for one Klub wey di nem na Reggiana.E bin plai wit Obafemi Martins an som oda Naija pleya-dem. For July 2001, Roma bin sign Wahab an Obafemi Martins for 3 billion lire from Reggiana and dem kolet Giuseppe Di Masi for 2.5 billion lire. For 2001-02 seesin dem loan Wahab bak to Reggiana.For di 2002-03 seesin e plai for Roma Primavera team an for 2003-04 seesin dem promot di tim go fest tim.Wahab plai one taim for Serie A an one taim for di 2003-04 UEFA Cup wen e enta for Daniele De Rossi against FK Vardar. Wahab stil plai for Bologna for di 2001 Torneo Citta di Arco.

Bellinzona[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 2007, AC Bellinzona sign Wahab. For di 2009-10 seesin, e go SE Eivissa-Ibiza an e plai smol frendili mash wit dem.Di Klub no du di transfa bikos dem komot di klub fom wey dem dey. Afta som taim dem vet pamishion to enta bot as niu klub wey dem dey kol UD Ibiza-Eivissa.

For October an November, Wahab plai two lig games for Bellinzona. For January 2010, dem no add e nem for di tim bot dey leta add am for di offishial tim rosta for 2010-11 seesin.

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]