Adetoyese Olusi
Adetoyese Olusi (wey dem bon for 29 October 1967) na di Ezekutiv Shaman of Legos Island Lokal Govamet. Na Adetoyese bi di Ezekutiv Seketiri for di Legos Island Lokal Govamet from 10 January 2015 go rish 6 June 2016 an also Vaiz-Shaman/Supavaiso for Edukeshon from 2008 go rish 2014. For 2017, Adetoyese win di eleshon wey mek am bi di shaman of Legos Island Lokal Govamet. Na APC (All Progressive Parti) e tek kampain. Wen dem kaunt di vote wey Adetoyese tek win, e yuz 13,000 pass di pesin wey kari sekod for di eleshon. Na Hon. Wasiu Eshinloku Sanni komot as shaman bifor Adetoyese enta in 2014. Pipo dey tok sey Adetoyese an im broda Adesola Olusi dey kwurel weyda mek im or im broda kari eleshon wey mek Adetoyese enta as shaman dat year.For 2017, Adetoyese win di eleshon wey mek am bi di shaman of Legos Island Lokal Govamet. Na APC (All Progressive Parti) e tek kampain. Wen dem kaunt di vote wey Adetoyese tek win, e yuz 13,000 pass di pesin wey kari sekod for di eleshon. Na Hon. Wasiu Eshinloku Sanni komot as shaman bifor Adetoyese enta in 2014. Pipo dey tok sey Adetoyese an im broda Adesola Olusi dey kwurel weyda mek im or im broda kari eleshon wey mek Adetoyese enta as shaman dat year.
Hau im tek stat life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Dem bon Adetoyese Olusi for 29 October 1967. E kom from Yoruba orijin from Oke-Arin wey de Legos Island. E papa nem na Alhaji Tajudeen Oluyole Olusi an e kom from royal famili. E mama wey bi di fest pikin from im own famili na: Iyabo Olusi. Adetoyese na prinsss an di gra-pikin of Oba Sanusi Olusi (late Eleko) Adetoyese wife na Alhaja Ameenat Olusi an di marej don produs pikin-dem.
Hau im tek go skul
[chenj-am | chenj-am for orijin]Adetoyese go Kuramo Pamari Skul wey de Victoria Island. Na Govamet Kolej , Victoria Island na im Adetoyese go do im sekondri Edukeshon. Adetoyese go do im OND an HND in Kwara Stet Politeknik. For Kwara Stet Politeknik, e stodi Bankin an Finans.
Adetoyese get satifiket from NICA (Cooperate Administration from the Nigerian Institute of Corporate Administration)
Hau im tek wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]Adetoyese Olusi fest esperiens kom wey e work as Youth koppa at Federal Ministri of Intana Hafihas in Oyo Stet. Inside di ministri, e work as hadministrative Offisa. Afta wey Adetoyese finish im koppa sarvis, e go work for LBIC (Legos State Building Investment & Co.) as Dua Supavaiso/Bankin Offisa. E also do Supavaiso/Klarin Offisa for Inland Bank Nigeria Plc.
Hau im tek put bodi for politis
[chenj-am | chenj-am for orijin]Adetoyese fest enta politis mata wen e bikom di P.P.P (Poblik-Pravet Patnaship) ward parti Shaman Ward A3. Adetoyese leta got oda hasaimet as di Hasistat Seketiri (A.D) an L.G.A Ex Officio (A.C.N) Legos Stet Shapta. Adetoyese stil work in Legos Island Lokal Govamet in difren dipatmet an some of dem na:
- Supavaiso for Health onda Mrs Aderinola Disu Hadministrashon
- Vaiz-Shaman/Supavaiso for Edukeshon onda Honorebu Wasiu Eshinlokun Sanni (2008 go rish 2014)
- Ezekutiv Seketiri from 2015 to 2016
- For now, e bi Ezekutiv Shaman of di Legos Island Lokal Govamet.