Adeniyi Adegbonmire
Hau e go bi
Adeniyi Ayodele Adegbonmire na Naija politishian. E bi senato wey dey represent Ondo Central for Naija Senate (di big pipul haus wey dey make law for di kontri).[1]
Wok wey e don do
[chenj-am | chenj-am for orijin]Adegbonmire na loya, and dem don giv am big loya taitul wey dem dey kol Senior Advocate of Nigeria (SAN).[2] E go skul for Obafemi Awolowo University, for di Law Faculty (na wie pipul dey len to be loya).[3]
E bi memba of one politikal pati wey dem dey kol All Progressives Congress (APC). For 25 February 2023, e win di eleshon for Ondo Central durin di 2023 National Assembly eleshon.[4] E bit di pesin wey olmost win am, wey bi Ifedayo Adedipe from Peoples Democratic Party (PDP).
Wie dem gada di tori
[chenj-am | chenj-am for orijin]- ↑ Nwafor (2024-06-12). "10th NASS: l've sponsored 3 bills in one year- Ondo Senator, Adegbonmire". Vanguard News. Retrieved 2025-04-01.
- ↑ The Nation (October 12, 2022). "'All permutations favour APC victory in Ondo Central'". thenationonlineng.net.
- ↑ Akinboyo, Temidayo (February 8, 2023). "ANALYSIS: Senatorial Elections: APC, PDP make it two-horse races across Ondo's districts". premiumtimesng.com. Retrieved 2025-05-01.
- ↑ Oluwole, Josiah (February 26, 2023). "#NigeriaDecides2023: APC wins Ondo Central senatorial election, Akure Reps seat". premiumtimesng.com. Retrieved 2025-04-01.