Adenike Adebukola Akinsemolu
| Man abi wuman | wuman |
|---|---|
| Kontri wey e kom from | Naija |
| Nem for lokal langwej | Adenike Akinsemolu |
| Fest nem | Adenike |
| Famili nem | Akínṣẹ̀mólú |
| Wen dem bon am | 20. century |
| Ples wey dem bon am | Ondo State |
| Fest langwej | Yoruba Langwej |
| Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, Naijá langwej, Yoruba Langwej |
| Langwej wey e tek rait di wok | English langwej |
| Wok wey e dey du | profeso, social entrepreneur, lecturer, raita, environmentalist |
| Pat of wok wey e put mind | teaching, raita, advocacy, lecturer, author |
| Wu e dey wok for | Obafemi Awolowo University, Clinton Foundation |
| Wie e go skul | Babcock University, Obafemi Awolowo University, Federal University of Technology Akure |
| Academic degree | master's degree, doctorate, Doctor of Philosophy |
| Wie e dey liv | Naija |
| Memba of | Green Campus Initiative |
| Awod wey e kolet | Robert Bosch Stiftung |
| Official website | https://greeninstitute.ng |
| Personal pronoun | L484 |
Adenike Adebukola Akinsemolu na pesin wey dey faight for beta way wey we go tek kip our environment kleen an beta for future. Shi bi ticha, raita, and pesin wey dey du biznes to hep society. Shi dey tich for Obafemi Awolowo University (Adeyemi College Campus).
Pipu sabi her wel wel as one of di oga dem for Nigeria wey sabi environmental sustainability (di way wey we fit tek liv weyno go spoil di environment).
Wok wey shi don do
[chenj-am | chenj-am for orijin]Akinsemolu na di pesin wey stat Green Campus Initiative, wey leta turn to Green Institute. Shi stil stat one program wey dem kol Girl Prize, wey dey hep yung secondary skul girls for Nigeria wit money an mentorship to push dem forward.
How shi wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]Adenike Akinsemolu na Ondo State shi fom come. Shi go skul for Babcock University an Federal University of Technology, wia shi kolet Master's an Ph.D for Environmental Microbiology. Shi stil do one extra program for education for Obafemi Awolowo University.
Shi don wok wit Clinton Foundation for New York bifor shi kom bak Nigeria kom stat Green Campus Initiative.
Shi bi Associate Fellow for Royal Commonwealth Society an shi dey among di pipu wey dey lead Sustainable Energy Practitioners Association of Nigeria (SEPAN) onda Ministri of Power.
In 2015, shi win Nigeria Energy Awods for di wok wey shi do on energy efficiency and awareness. Shi dey holways tok sey mek dem put green education an sustainability for Nigerian school curriculum.
Shi dey wok wit United Nations Sustainable Development Solutions Network, an shi bi Scientific Committee Member for di 6th Annual International Conference on Sustainable Development (ICSD) for Columbia University.
For 2020, shi rait one buk wey dem kol "The Principles of Green and Sustainability Science," wey explain different wahala wey dey afect sustainability for Afrika.
For March 2021, dem recognize ha as one of di best young leaders for Africa wey dey faight for environment protection. She win Africa’s Top 100 Young Conservation Leaders awod fom difren international organizations.
Green Institute
[chenj-am | chenj-am for orijin]For 2015, Akinsemolu start Green Campus Initiative (GCI), di first university-based environmental advocacy organization for Nigeria. E get awod for South Africa bikos of di gud wok wey dem dey do for university campuses.
For 2016, GCI turn to Green Institute, wey bi skul an research center for sustainability. Profesor Damilola S. Olawuyi bi di first president of di institute. Di school dey tich pipu how to tek care of di environment an how dem fit stat business wey go hep society.
Di institute bi bi di first school for Nigeria wey dey hep students pay skul fees wit waste management program wey dem kol "Trash for Education." Di program dey mek students kari waste kom, kolet points, an uze am pay school fees. Na di stet govment an private kompanies dey buy di waste.
For June 2020, di institute organize one big Global Sustainability Summit on World Environment Day (5 June). More dan 25 sustainability leaders fom difren kontries join, including one oga for ekonomi an environment, Jeffrey Sachs.
Soshial mata & advocacy
[chenj-am | chenj-am for orijin]Akinsemolu dey holways sopot girl-child edukeshon an shi stat one program wey dem kol "Girl Prize", wey dey giv scholarship an train yung girls. Shi don stil folo Clinton Foundation hep pipu wey suffer fom natural disasters, lik 2004 Indian Ocean earthquake an Hurricane Katrina for New Orleans.
Awods & Recognishon
[chenj-am | chenj-am for orijin]
.Robert Bosch Stiftung Young Researcher Award