Adekunle Ajasin University

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

Adekunle Ajasin University, Akungba-Akoko (AAUA) na one Stet yunivasiti wey dey Naija. Di yunivasiti dey Akungba Akoko, Ondo Stet for Naija.

Tori of di skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di old Ondo Stet Govament wey late Shif Michael Adekunle Ajasin bi di govno fest kret Adekunle Ajasin University as Obafemi Awolowo University in March 1982.Wen Militri Govament wey Michael Bamidele Otiko bi dia Nevi govno kom tek ova pawa, dey chenj di nem to "Ondo State University in 1985". Dey nid to kari di yunivasiti go Akungba-Akoko wey dey di niu Ondo Stet in 1999 bikos of di niu stet dem wey dey komot fom di old Ondo in October 1996.Na forma govno ofdi Stet Shif Adebayo Adefarati put hand for pepa sey mek dey kari di skul go Akungba-Akoko in November 1999.Dis chenj mek some woka komot for di old site wey dey Ado-Ekiti to Akungba-Akoko for December 1, 1999. Dey stil mek anoda law to chenj di nem of di yunivasiti to "Adekunle Ajasin University" bikos dey wan yuz am tek rimemba late Govno Ajasin.Na Govno Adefarati sign di law in 2004 wen Ajasin die.

Akademi[chenj-am | chenj-am for orijin]

Adekunle Ajasin University ofas ondagraduate, Post-graduate as well as Pre-digri, JUPEB program in aria wey bi Science, Arts, Education, Law, Social and Management Science, Agricultural Science, Environmental Design and Management.

Falkoti an Dipatment wey dey di skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di yunivasiti get 7 Falkoti an dey bi:

Di Dipatment wey dey di skul bi:

Pipul-dem wey don bi Vais-Shansellor[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na di akademi an administrative Shansellor dey hep di Vais-Shansellor for di skul.

Nem of Vais Shansellor Date
Prof. Akin Akindoyemi January 2000 to January 2001
Prof. Olusola Ibukun (Acting January 2001 to May 2002
Prof. Funso Akere 4 May 2002 to 30 April 2006
Prof. Femi Mimiko (Aktin) May 2006 to October 2006
Prof. Dr. Med. Philip Abiodun 1 October 2006 to 18 June 2009
Prof. O. Awobuluyi (Aktin) 19 June 2009 to 3 January 2010
Prof. Femi Mimiko 4 January 2010 to 3 January 2015
Prof. Igbekele Ajibefun 6 January 2015 to 5 January 2020
Prof. Olugbenga E. Ige (Aktin) 6 January 2020 to 6 July 2021
Prof. Olugbenga E. Ige 7 July 2021 till date