Jump to content

Adanna Steinacker

From Wikipedia

Adanna Steinacker (wey dem bon as Ohakim for 2 March 1988) na medika dokto, bizneswuman, tok-tok pesin, dijital influensa, an wuman wey dey push wuman palava wel-wel. Shi bi Senior Special Assistant to di Presido of Naija, Bola Ahmed Tinubu, on top Wuman Health mata.[1][2][3]

Shi get her own brand wey dem dey kol House of Adanna - na creative platform wey dey help wuman dem shine. Di brand dey produs kontent abaut helt, hau pesin dey fil fain insaid bodi an mind, hau to tek kia of di earth, as wuman dey raise pikin, an ikwol raits for all. Shi also sopot Sustainable Development Goal (SDG) 5 (jenda ikwoliti) and SDG 3 (gud helt and wel-bin). Ova 1 million pipul dey folo ha komuniti online.[4]

Pesonal laif an skul

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Adanna kom from Imo State, Naija. Shi bi one of five pikin dem wey Ikedi Ohakim (biznesman, politishian, foma govno of Imo) and Barrister Chioma Ohakim bon.

Shi finish sekondri skul for Naija, den go University of East Anglia, UK wie shi get BSc for Biomedicine for 2010. Afta dat, shi go Royal College of Surgeons in Ireland (RCSI), wie shi kolet ha medical degree (MB, Bch, BAO, LRCP, SI) for 2015.

Na for yunivasiti shi meet David Steinacker wey bi German. David bigin wok as biznes konsultant for teknoloji kompani from 2012. Dem du three wedin serimoni: Tradishona Igbo wedin (Igbankwu) for Naija December 2013,[5] Kot wedin for Germany - March 2014, Choch wedin for Dublin, Ireland - July 2014.[6]

Dem wedin vidio go viral - ova 2.8 million pipul don woch am.

For October 2017, Adanna stat one kompani wey shi kol Medics Abroad - na intanashonal oganaizeshon wey dey help medikal student dem find place for Africa to do clinical training. Kontris laik Kenya, Ghana, Rwanda, an South Africa join. Shi wan ekspand go oda African kontris tu.[7][8][9]

But for 2020, COVID-19 pandemik afekt di kompani wela, jos one yia afta shi stop klinikal wok to fes biznes ful-taim.

Shi bi big dijital influensa - pipul sabi her wel from 2014 wen one shot 15-seconds Instagram vidio of ha and David dey dans Afrobeats for kichin go viral. Shi and ha hosband stil show for BBC documentary: YouTube Couples: How to Stay in Love for 2018.

Shi form Adanna David Digital Ltd., wey dey manej ha social media wok and help brands for influensa maketin. Dem don wok wit big nem kompani dem like: L’Oréal, Dubai Tourism, KLM, Disney and eBay.

Wetin shi dey fait for

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Adanna tok say shi bi Black African wuman and shi identify as feminist - shi dey fait malek wuman get same opotuniti and respekt as man.

Shi don tok for big-big konfrens dem laik: World Economic Forum (WEF), United Nations Climate Change Conference, Goalkeepers Initiative by Bill & Melinda Gates Foundation

Shi dey put eye for wuman pawa, helt, sustainability, ikwol rait, an SDG 3 (helt).[10]

Wia dem gada di tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  1. "Meet Dr Adanna Steinacker, the young woman on a mission to change how foreign medical students are placed in hospitals in Africa". www.pulse.ng (in Amẹ́ríka Ínglish). 20 February 2019. Retrieved 20 April 2025.
  2. "Adanna Steinacker". WETM-IAC (in Amẹ́ríka Ínglish). Retrieved 2025-04-20.
  3. Uriri, Francesca. "Leading Ladies Africa Nigeria's 100 most inspiring women in 2019". The Guardian. Retrieved 20 April 2025.
  4. Steinacker, Adanna (8 February 2021). "'Here's What We've Learned Raising A Family As An Interracial Couple'". Grazia. Retrieved 20 April 2025.
  5. Weddings, BellaNaija (3 March 2014). "BN Weddings: Adanna & David! The German Wedding". BellaNaija (in Amẹ́ríka Ínglish). Retrieved 20 April 2025.
  6. Weddings, BellaNaija (13 October 2014). "BellaNaija Weddings presents Adanna & David's Wedding! From Imo to Germany & Ireland". BellaNaija (in Amẹ́ríka Ínglish). Retrieved 20 April 2025.
  7. "Medics Abroad Announces Partnership". The Guardian (in Brítísh Ínglish). Nigeria. 17 January 2020. Archived from the original on 17 January 2020. Retrieved 20 April 2025.
  8. "Medics Abroad and RCSI Bahrain partner to recruit Nigerian students for medical studies". The Sun Nigeria (in Amẹ́ríka Ínglish). 17 January 2020. Archived from the original on 13 February 2020. Retrieved 20 April 2025.
  9. "A JOURNEY WITH MEDICS ABROAD". Light Magazine Africa. 6 September 2018. Archived from the original on 22 August 2020. Retrieved 20 April 2025.
  10. "Adanna Steinacker". WETM-IAC (in Amẹ́ríka Ínglish). Retrieved 20 April 2025.