Ada Udechukwu
Ada Udechukwu (bon 1960) na Nigerian artist an poet wey dem sabi as pat of Nsukka grup.
Ha life tori
[chenj-am | chenj-am for orijin]Ada Udechukwu na Enugu shi for born, wey dey southeastern Nigeria. Ha papa na Igbo man, and her mama na American wuman.
For 1967, di eastern pat of Nigeria wan komot fom di kontri to form dia own nation wey dem kol Republic of Biafra. Dis one lead to big faight wey dem kol Biafra War (1967–1970). Bikos of di war, shi and ha brodas and sistas folo dia mama go Michigan, USA, go stay for safety. But dia papa stil dey for Nigeria. Dem stay for America until 1971, one year after di war don end.
For University of Nigeria, Nsukka, shi len onda writer Chinua Achebe an kolet ha digre for English and Literature. She start to dey design cloth with painting wey e get fine line style. By 1988, shi stat to dey draw for paper, dey uze ink an watercolor. Dis ha drawings dey sho di balance wey she dey try get as woman an artist. Shi also dey use her art tek tok abaut how e be to get mix identity, for Afrika an outside Africa. The Newark Museum of Art get som of her wok. Shi bi one of di few wuman wey dem sabi as pat of Nsukka grup.
For 1997, when Nigeria military govment wahala strong, ha hosband Obiora Udechukwu, wey bi artist, get teaching wok for St. Lawrence University for New York. Shi, ha hosband, plus dia two pikin, Ijeanuli an Nwora, komot go Amerika, an dem never kom bak sins.
Ha raitin wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]Ada Udechukwu sabi rait wel wel, espeshialy poetry. Shi stil sabi rait shot stories. Ha buk of poems an drawings, Wuman, Me, kom out for 1993 onda Boomerang Press. One of ha shot stories, Night Bus, enter The Atlantic magazine for August 2006. Shi stil rait one children buk wey shi title Herero for 1995.