Abubakar Atiku Bagudu
Hau e go bi
Abubakar Atiku Bagudu (dey bon am 26 December 1961) na Naija politishan wey bi di Naija minista of bodjet an ekonomik plani. Bagudu na Kebbi Stet gofnor fom 2015 go rish 2023. E don du sinetor wey repiset Kebbi Sentra Senetoriha district fom 2009 go rish 2015.[1][2]
Hau e tek stat laif an go skul
[chenj-am | chenj-am for orijin]Bagudu famili get moni wel wel. E papa na di daretor of pamari edukeshon in Kebbi Stet. Bagudu go Usmanu Danfodiyo Yunivasiti, Sokoto go rid ekonomik an e kolet B.Sc satifiket. E du im masta for Yunivasiti of Jos. Bagudu du M.A (Intanashonal Affairs). Bugudu mari Zainab Bagudu.[3][4]
Hau im tek put bodi for politis mata
[chenj-am | chenj-am for orijin]For 2009, Bagudu bikom sinetor for di Kebbi Sentra Senetrariha sit. E tek ova fom Adamu Aliero wen Aliero liv di posishon to bikom Minista for FCT dorin Goodluck Jonathan in December 2008.
Wie dem gada di tori
[chenj-am | chenj-am for orijin]- ↑ "Atiku Bagudu elected in kebbi".
- ↑ "Kebbi State Government". Archived from the original on 2021-07-09. Retrieved 2026-09-08.
- ↑ "Kebbi Governors".
- ↑ "National mirror". Archived from the original on 2012-03-20. Retrieved 2026-09-08.