Jump to content

Aadun

From Wikipedia
Aadun
snack, food
Native labelÀádùn Chenj-am
KontriNaija Chenj-am
Indigenous toYoruba pipul Chenj-am
Country of originNaija Chenj-am

Aadun na one smol smol fud wey popula wey pesin fit bai for strit wen you de stet wey Yoruba pipul de for Naija. Di minin of di nem of di fud Aadun na swit-ness. Pipul dey chop am wel wel wen dem dey du marej parti an dorin nemin serimoni.[1][2]

Tori abaut di fud

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di four mejo tins wey dem dey yuz mek Aadun na:

  • Korn flawa.
  • Chilli pepe
  • Pam orye
  • Salt

Na two katigori of Aadun de an dem bi: di ordinari korn-flawa, an di one wey dey yuz plenti Pam orye du. Di Aadun wey di pipul of Okun dey du dey get bean wey dem don mash wel wel. Di Okun pipul dey yuz banana lif kova dia Aadun so dat di fud fit get one kain difren taste.[3][4]

Wie dem gada di tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  1. "How to make the street snack aadun in your home; Guardian Ng".
  2. "Aadun; Wjarr".
  3. "Exploring the cultural taste buds of Nigeria; Guardian Ng".
  4. "Aadun a savory snacks; EveryEvery Ng".